AUGUST 8TH BREAKING NEWS; As we dey talk soooo Ebola don enter - TopicsExpress



          

AUGUST 8TH BREAKING NEWS; As we dey talk soooo Ebola don enter Nigeria citizens confirm, but the rumour of say make u bath with salt na big lie, all na to gain attention by local media..... Just yesterday nai American begin pursue all liberians comot from US and order no plan to travel go any West Africa country......... According to scientist yesterday dem say dis na the world must deadliest disease and might condemn d world under 2 years and e don start now........ As I dey talk to u sooo campus 1 and 2 for auchipoly dry die as students refuse to come class bcos of waiting dem hear, abeg make una go class oooooooo.......... EBOLA VIRUS INTERNATIONAL (EVI) That na the name wen we give am bcos na international virus wen dem don bring come again to take make money just like AID/HIV...... Dem say na liberia man nai bring am come 9ja and na American he for get am, why e b say if we travel enter Europe dem go begin check our teeth and all our body bfore we go enter their country and if dem wan come our own we go allow dem pass like ant? Make our government answer dat question oooooo................ Ok just last week nai liberia government begin shoot school down to avoid the spread of the disease and now for liberia dem dey troway any Ebola dead patience for road like dat, my people dat 1 good?................ But make we think am oooo some people go say God nai dey give and na him dey take me I no sure say dat na true becos American and Russians na create dis Ebola disease d same way wen dem take create AID/HIV from their lab becos say dem wan do nuclear weapon and dem come carry am come Africa come experiment am for Africans body. One thing wen una must know b say e no get disease wen no get cure! And American get the cure to dis disease bcos this Ebola na man nai make am....... Just yesterday na we dey here say one Nigeria female doctor wen dey treat dat liberian man bfore he die don die for Ebola disease......... Our Nigeria doctor dey her own ooooooo wen dis Liberia American man come from liberia come spread am for Nigeria here and we come hear say d 2 American doctor wen contact the Ebola virus wen dem dey treat some patience for liberia dem don fly dem go American last week and from d latest ABC and Goodmorning American news say as of today those 2 doctors don dey recover small small so d question wen I wan ask b say y our own doctor go come die?.............. American dey use our head ooooo for this Africa and dem get question to answer. Concerning dis disease cos na dem nai bring am come with their so so lab things wen dem dey do, and our stupid leader go just dey find their own personal interest while d people wen dem say dem they protect Dey die troway like fly........... According to report dis disease don dey exist since 1976 why dem no find cure for am since? Make dem hold all dis our so call leaders responsible oooooo. Cos according to one radio programm yesterday one Nigeria herbal man say he get cure for the Ebola disease but of doctor dey say no cure! And for many years now Nigeria government no one gree use herbs as a major way of treatment instead dem prefer Abroad own. my people d thing wen government dey do so good? Thank God say EBOLA na senior brother to AID so e go fit enter anywere even ASO ROCK self................. The last report wen we come hear yesterday nai be say the USA government get cure for the Ebola disease and nai dem take dey heal those 2 doctors sooo but before dem go treat any Affected patience, the patience need to get their medical data base identification (MDBI) and dem say without dat code dem no go treat the person and dat code nai be d mark of the beast wen bible dey talk about soooo. Dem bring dis virus bcos dem no say na d only way dem fit take convince to join dem for the underworld. Hmmmmmm tshia..............there is God oooooooo dis virus u people are sharing there is God ooooooooo.............. So we dey call on our government to make sure say dis nonsense no spread ooooo cos we hear yesterday for channels news say 7 Nigerians don dey Effected for lagos there 5 of them run and 2 nai dem fit catch hmmmmmm make una find the other 5 people ooooooooo........... With dis note now we don know say d only way wen we no go fit get am na to dey vigilant and avoid hand shakes or f possible always put on hand gloves and if you see any form of the symptom for anybody body weda na ur friend,family members or lover make u alert the nearest police station of security agency wen dey near you oooooooo.......... The picture wen dey ground so na d Ebola patience for liberia wen dem dey troway for road now like rat............ Finally this na the prayer wen we go they pray every day for our daily devotion, EBOLA SHALL NEVER COME TO ME MY FRIENDS OR MY FAMILY MEMBERS IN JESUS NAME AMEN............. My people how una see waiting we talk soooooo e correct abi e no correct make una share am for all una facebook friends make dem also talk their view.......... NA ME THE OTOTA OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY AND D EAGLE EYE OF AUCHIPOLY,
Posted on: Fri, 08 Aug 2014 06:30:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015