...Abeg Ladies dey Careful. See as BOYFRIEND BRING 7 FRIENDS CON - TopicsExpress



          

...Abeg Ladies dey Careful. See as BOYFRIEND BRING 7 FRIENDS CON RAPE Ihn BABE ...See pesin see wahala o, wetin pesin no dey see. See how Guy carry Seven Men con rape ihn girlfriend coz dem don breakup. For wetin na! De police don arrest one Stephen Obi onto say ihm gather seven men make dem go rape ihm former babe. De babe na 28-year dey for Lagos State, Nigeria. According to de babe, she decide make she end dem relationship bicos Obi yan say ihn no dey ready to marry am, and she senior am with 5 years, Obi self no too like de parole. See mata o, na so ihn organize seven of ihn padi make dem go kerewa de babe. Wetin happen? Dey hear o. On dat day Obi invite de girl friend make she come Baba Olopa Street, Adexson, for Igando wey dey Lagos make dem settle dem beef. She no think twice na so she waka go . She yan say as she enter ihn room, seven of ihn padi come inside, dem con lock de room con dey beat am con tell am make she turn to stripper. Oya! Sharp sharp comot ya cloth, as you enter de room we wan enta de place. Na so Obi (de Bobo) comot rubber Compact Disc (CD) begin dey share am, oya take ya own, ihm share make ih reach all of dem. After ihn share finish na so dem push de babe make she go down low con begin dey do kerewa on afta de oda. Dem make sure dem complete dem dosage, no remainder. De babe tell her papa about de ugly thing wen she go house, na ihn dey go Igando Police Division go report de mata. Na dat time dem arrest Obi con charge am go court, but de other seven ja for dem life. Dem don charge Obi with conspiracy and rape for de Ejigbo magistrate court, and dem still dey find de seven wey remain. When dem bring de mata on Wednesday,ihn plead not guilty to de two-count charge. Mr M.B. Folami wey be de presiding Magistrate, yan say after dem don go through de doctor’s report dem yan say make Obi dey for prison custody. Dem adjourn de case go 23rd September, 2013. Chai!.. See babe wey ihn dey tell "I LOVE U" con carry 7men make ihn go kolonbi am. Y na!. Water don pass garri o.. ¤OGBONGE NAIJA¤ Follow on twitter @OgbongeNaija
Posted on: Thu, 12 Sep 2013 18:17:34 +0000

Trending Topics



tbody" style="min-height:30px;">
Oh this is one is Great For the Holidays!!! Feel Free to tag
20,000 Americans live with hemophilia, a condition that prevents
First : Band of skulls. Mieux que je ne limaginais. Second : ...

Recently Viewed Topics




© 2015