Abeg no laugh... Blackberry don chop my money tire,na him I come - TopicsExpress



          

Abeg no laugh... Blackberry don chop my money tire,na him I come vex yestaday sell am, come take some money buy China phone! Now amin bigger trouble!!!1. E go full after 3 minutes of charging.2. The phone get TV, Touch screen, Nail cutter, Firelighter etc.3. I fit write Text message with a toothpick sef.4. The spelling get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-pon, samswag etc.5. When aeroplane pass e go record One missed Call.6. When a big car horn; e go show Charger connected7. When Chinese man pass e go show: One Bluetooth device found8. When fine gal waka pass, e go show Ur favourite food found9. When ugly gal waka pass, e go show,Virus detectedAbeg I wan sell am! Who wan buy ooo?Even as I dey find buyer, e dey show me for screen: No contact found. I don tire....................
Posted on: Sat, 08 Mar 2014 07:02:58 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015