Agnes Olufunke Atoyebi *You used BlackBerry to oppress, now - TopicsExpress



          

Agnes Olufunke Atoyebi *You used BlackBerry to oppress, now everybody has a Blackberry. *You used ur camry to Buga, now boys use Camry to do taxi. *Before you dey use ur plasma screen dey swell.... now dem don dey use am watch ball for buka. *Before you dey use your iPad dey swag...,now iPad na heavy load to carry comot house, *Before you go dey use brazillian hair dey form big girl, secondary school student don dey wear am troway, *Before you dey go vacation for UK dey talk pass yourself, boys don dey buy 1st class ticket dey enter London just to go lick Ice cream.... BOTTOM LINE: No dey over do like say that thing no go reach another person hand! All na vanity, e dey fade like Aba Jean..,no forget say tortoise car na big man motor b4 o.. Nothing wey come wey no get expiring date, even the life you have na borrow you borrow am.. HUMILITY na the best choice!!!!
Posted on: Mon, 10 Jun 2013 15:14:15 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015