Arsenal don dey see road small to see weda dem kwalify for de - TopicsExpress



          

Arsenal don dey see road small to see weda dem kwalify for de knockout stage for dis seasin Champions League, afta dem waya Olympique Marseille 2-0 for dia Group F match wey dem play for Emirates Stadium. Marseille, wey neva kollect even one point for dis seasin competition bin wan use Arsenal arrange tins but yawa go as for de veri fes minute of de match as Jack Wilshere score wit beta laba-laba wey kipa Steve Mandanda no fit catch to make am 1-0. Mesut Ozil sef come miss penariti for de fes haf afta dem drag Aaron Ramsey for ground as Arsenal begin dey show de France team pepper. Dem miss plenti chance for de fes haf to add more gols. Jack Wilshere come setul matter for de secon haf as hin score Arsenal secon gol to take kill de match, as de gunnas go now enta Napoli side for dia las group match to find point wey go make de kwalify for de knock-out. Dortmund come make de arithmetic be one kain as dem waya Napoli 3-1 for Germany dia. Na Marco Reus fes score for Dortmund for de 10 minute thru penariti bifor Jakub Blaszczykowski make am 2-0. Napoli come drag one gol enta Dortmund net as Lorenzo Insigne gol come gif dem hope, But Gabon strika Pierre Emerick Aubameyang come scatta dia plans come make am 3-1 for de Germany team. Ajax Amsterdam be de baba for Tuesday Champions League gbege as dem beat Barcelona 2-1, but Barca don alreadi kwalify sha. Lionel Messi bin no dress for de match as Ajax show Barca pepper for de fes haf. South Africa pikin Thulani Serero fes score for Ajax for de 19 minut bifor Danny Hoesen come make am 2-0 jus bifor haf time. Yawa come gas for Ajax as second haf resume as Joel Veltman kollect red kad waka lif field. Xavi come kollect one gol from pena for Barca but Ajax sef manage hol dem till match kpai. Milan do Celtic shege dia for Scotland sef and na Kaka bin de conductor wey helep dem win. De Brazil guyman open road for Milan for de 13 minute bifor Cristian Zapata make am 2-0. Secon haf sef no gud for Celtic as Mario Balotelli come add hin own join to make am 3-0 for de Scotland team bakyad. Chelsea, wey don already kwalify for de knock out stage enta Switzerland wit korrect swagga but Basel come do dem strong tin as Mohamed Salah gol for mortuari time come make am say Basel don beat de England team home and away dis seasin be dat. Our naija pikin John Mikel Obi play de match and hin even chop yellow kad for de match as e come be say na de two teams go waka enta de knock out stage as Jose Mourinho come tear for hin boys say dem supose lose sef. Na veri bad match, dem supose win us, Mourinho tok$ I no llike wetin we tap from fes minute reach las sef. Na all de results from Tuesday matches be dis: Zenith St Petersburg 1 Atletico Madrid 1 FC Porto 1 Austria Vienna 1 Celtic 0 AC Milan 3 Ajax 2 Barcelona 1 Borussia Dortmund 3 Napoli 1 Arsenal 2 Olympique Marseille 0 Basel 1 Chelsea 0 Steaua. Bucharest 0 Schalke 04 0
Posted on: Wed, 27 Nov 2013 09:23:45 +0000

Trending Topics




© 2015