..BABE FOR SALE O ...I don dey Boil Since Morning. E get this - TopicsExpress



          

..BABE FOR SALE O ...I don dey Boil Since Morning. E get this my cousin eh, I just really no know if de Creators decoration on her no dey good enough for her bodi. ..She be student of OAU, She dey chocolate, tall, with dimple. Her name na Yetunde but for school I no sabi wetin dem dey call am for school. U sabi gurls na, dem too dey tush dem names. ..Yetunde come visit us and don dey my house since Friday. ..And, the way she dey do her body or skin don dey make me no be myself again o. ...See me see wahala, This morning for her room, I just dey watch her dey vex as she dey make up herself for church. ..She first glue her face to the mirror. She pour something like water for her hair and begin dey rub am ..She put plenti powder for her face..TIME STILL DEY GO O. She pluck her eyebrows, paint her eyelashes, she apply lips stick (2colours). I dey Boil dey go, TIME STILL DEY GO. Come Yetunde see time o, Oh Yes I can see it she replied I swallow spit. Chai! If na my wife be dis eh!.. Make I sha dey wait dey go, coz na me dey drive, I for don leave am go church jeje. Bt na bicos she no too sabi road I just gat wait for am. ..My own Younger sister wey even senoir am, don dress don finish, she just dey smile dey yan me say na student she be Make she take her time. ..After 30 minutes don waka, she yan me say she don thru. She come turn to me and ask, hi, MOJoJo Do I look good, Definitely, Her face don change totally, within me I was like Wo iyamoja to wa ni aye yi oooo, and I replied Oh! Yea, youre looking good, but youre going to a church not a night party and she smiled. ..In order for de compound people not to see her in her odd looks, she shapaly sneak enta de car I just wonder how Yetunde dey dress for school self. ABEG I NEED URGENT SALES RIGHT NOW, NOW SHE DON YAN SAY SHE GO DEY FOR OUR HOUSE TILL ASUU END DEM STRIKE Or Abeg Wetin me go do dis cousin of mine o. Wait o with such look you no fit get beta husband na, na wuruwuru boifriend you go dey get na ..So abeg if You want Buy Yetunde she dey ups for grabs, she fine, she get good character but she too dey waste time de dress be my wahala Today I gat enta church by 8.45am wen Church begin by 8.00am. .. No Terms and Conditions Applied, Valid While Stock Last o. #MoJOJO ¤OGBONGE NAIJA¤
Posted on: Sun, 10 Nov 2013 17:28:52 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015