BACKPASS, August 13 MEDE MEDE LOCAL My people, the kasala wey - TopicsExpress



          

BACKPASS, August 13 MEDE MEDE LOCAL My people, the kasala wey dey NFF don tear leather oo, because as federal government dey try pour cold water for people body wey dey hot wen dem yarn say make Maigari return, the man wey dey there now, Mike Umeh don talk say make federal government hold im side oo, say make every oman just leave dem as na siddon im go siddon put as presido. Na dis mata make former player for Nigeria, Patrick Paschal cry say, CHEI, nor be so dem dey do am ooo, oga Umeh. Government dey try settle una gbege u come dey fall government hand. Paschal yarn say wetin Umeh and im people want be say make FIFA nack Nigeria baaad akpako! Cue...Umeh, Paschal Question: Mede Mede people, shey nor be say water wan pass garri so? INTERNATIONAL Yesterday we feel the power of the Galaticos as dem use Cristiano Ronaldo wound Sevilla for European super cup this night na the turn of Pep Guardiola to lead him own FC Hollywood to the Signal Iduna Park for the German super cup too, remember say by this time last year na this same Borussia Dortmund beat them for this same cup. Pep Guardiola don yarn say he must win this cup by fire by force. Question: Una think say this FCBayern wey dey do legbere for preseason go fit win this cup?
Posted on: Wed, 13 Aug 2014 08:07:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015