Backpass, October 8 Mede Mede EMMANUEL AMUNEKE WEY BE CHIEF - TopicsExpress



          

Backpass, October 8 Mede Mede EMMANUEL AMUNEKE WEY BE CHIEF COACHEE OF GOLDEN EAGLETS AND B4 B4 SUPER EAGLES PLAYER DON VIBRATE SAY D SUPER EAGLES KNOW WETIN DEY FOR GROUND ON SATURDAY FOR SUDAN WHEN DE, GO GBEGE FALCONS OF JEDIANE FOR AFRICA NATIONS CUP QUALIFIER AND E HOPE SAY D PLAYER GO NACK BALL TO KPAKE D 3 POINTS. STILL ON WE EAGLES MATA, 2004 NATIONS CUP CHIEF COACHEE FOR SUPER EAGLES , CHRISTIAN CHUKWU DON YARN SAY MAKE SUPER EAGLES ROLL OUT ON SATURDAY TO GBEGE SUDAN FOR MASSIVE DEFENCE AND MASSIVE ATTACK TO MAKE SURE SAY SUDAN COLLECT AKPAKO. QUESTION: DE PLAYERS DON LAND OO...OYA, WHICH AREA FOR DE TEAM MAKE KESHI SHOOK EYE PUT WELLA MAKE E FOR NOR SHAKE SHAKE WEN DEM JAM SUDAN?
Posted on: Wed, 08 Oct 2014 06:38:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015