Conversation between AIDS & EBOLA: AIDS: na who be dis - TopicsExpress



          

Conversation between AIDS & EBOLA: AIDS: na who be dis too? EBOLA: bro na me oooo, ur sis! i don show AIDS: Which kind bad market b dis na, watin carry u come EBOLA: Hmmmm bros why u dey yarn like dis na, ur reign never do u? Abi na only u dey dis world. I even hear say †hεm dn find cure fr you. AIDS: So who give u transport come Naija? EBOLA: Bros na one man from Liberia ooo. Him say make i accompany am come Nigeria. As we reach na him i carry leg leave am ooo. AIDS: so hw u want operate here? EBOLA: I go follow all d state wey get d same alphabet wit my name... Na for dos state i go operate. AIDS: name the states for me EBOLA: Ebonyi, Edo, Bayelsa, Bauchi, Benue, Borno, Oyo, Ondo, Lagos, Abia, Adamawa,Akwa ibom, Anambra. AIDS: u b baddo, so out of 36 states u take only 15?........ Sis u tyt. but u omit Enugu y? EBOLA: bros dat pple too neat gentle and u no say Fr. Mbaka de dere so i no dat man problem. even any body wey b Enugu blood i don swear say i no get dem tym, i stil won enjoy my shot stay cos i wil soon vanish like our cousins bird flu and sars. AIDS: ahhhh u self! na so so brain u carry. me self i don tire here self. dis ur vanishing idea mek brain ooo. i go reason too my broda. EBOLA: bro i bin here say boko haram dey worry for north? E b like i no go reach der ooo. I no wan die AIDS: Market no dey move der again ooo... lol......Just for fun #Stay safe, EBOLA is real..
Posted on: Mon, 11 Aug 2014 15:22:33 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015