Conversation between Rat & Student. Rat: Hello Student: Hello, - TopicsExpress



          

Conversation between Rat & Student. Rat: Hello Student: Hello, who i dey follow talk Rat: I be Mr sorbabi, abi? Student: you no recognize my voice again..na me ur room-mate Student: U say wat? Rat: i say, i be ur room mate, i dey ur room now. Student: i beg ur pardon! Rat: whch yeye beg u dey be? I never chop since u comot 3 months ago bcos of ASSU strike. I check dat place weh u dey keep food, i no c anything, kitchen nothing, fridge no single food even ur beaverages don expire. E be like say u want kill me of stavation. Or u think say na my papa be ASSU & F.G weh frustrat ona? No problem, i just say make i let u knw say dat ur certificate inside d wardrobe weh dem write Dimpka Nenzip, Univercity of Port-Harcourt; i don eat Dimkpa Nenzip commot, remaining University of Port-Harcourt. Let me c which work weh u go take only University of PortHarcourt go find 4 dis our yeye Country weh job no eveney...! Hmm..
Posted on: Fri, 18 Oct 2013 13:39:34 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015