Conversation between a RAT and MAN..... RAT: (with a tiny voice) - TopicsExpress



          

Conversation between a RAT and MAN..... RAT: (with a tiny voice) hello MAN: hello, who am I speaking with? RAT: Na Mr John be this? MAN: Yes u are speaking with Mr John, who is this pls? RAT: So you no recognise my voice abi? Na me your room mate MAN: You said what? RAT: Your room mate rat. I dey your room now... MAN: I beg your pardon RAT: Which yeye beg you dey beg? I never chop since yesterday, where you waka comot? I check that place wey you dey put food I no see anything, I check kitchen nothing. I even check fridge no single food there. E be like say you wan kill me abi? No problem, I jux say make I let you know say that your certificate for inside your wardrobe wey dem write LAGOS STATE UNIVERSITY I don eat "LA" comot, remaining "GOS" STATE UNIVERSITY. Let me see which work you go take "GOS" State University find..... (Rat ends call)
Posted on: Wed, 07 Aug 2013 17:04:23 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015