Cristiano Ronaldo score three tines for Real Madrid, as all - TopicsExpress



          

Cristiano Ronaldo score three tines for Real Madrid, as all de ogbonge team start dia Uefa Champions League waka wit red eye on Tuesday. Na thirty goal dem score for de whole Europe, and na Real Madrid show all man road, afta dem waya Galatasaray 6-1 for dia backyard (Galatasaray bin play for house). Bayern Munich bilala CSKA Moscow 3-kondo for Germany and Manchester United show Bayer Leverkusen pepper, for Old Trafford, as dem score four goal sef. PSG tell all man say dem go worry dis season, as dem waka go Greece go waya Olympiakos 4-1 and Manchester City sef draw rain, bicos na 3-kondo dem waya Viktoria Plzen (na Czech Republic club de dat). Na Ronaldo be de playa wey cost pass bifor, but as Real carri 100 million euro buy Gareth Bale from Tottenham Hotspur dis mont, no be so e be again, but na Ronaldo be baba for dat side sha, as he tap faya for de match. Upon de kin big money wey Real pay for Bale head, Se guyman no start match, but hin still enta for second haf, come helep Ronaldo arrange hin second goal. Real midfilda, Isco, start de gbege for Galatasaray, as na hin score de fes goal, bifor French strika, Karim Benzema score two goal, as new Real coachi, Carlo Ancelotti siddon like bad guy, de watch as hin team tap sweet futbal. "Dis match na helele. To score six goal no be beans, and our confido na die now," na im Ronaldo yarn amebo wen match finish. Even tho Real dey purshu dis Champions League cup de way he- goat dey purshu woman goat, dia coachi go don carri eye look de oda team dem, as demsef, play like hungry men. FES GOAL E neva even reach four mont wey Bayern Munich carri Champions League cup, but na onli four minit dey clock, wen David Alaba sama one helele free kick enta net. Arjen Robben follow score sef, wit Mario Mandzukic too, as Bayern new coachi, Pep Guardiola belle go sweet am bicos of de way dem win. Guardiola bin don carri Champions League cup two tines, wen hin be Barcelona coachi, and he tok say hin mind rest, as dem start dia waka for smooth toad so. "My mind rest well, well bicos of how we tap dis ball," na im he yarn. "De fes match afta you don win cup, no be beans. Pipu tink say e easy, but no be so." Meanwilly, Ronaldo forma paddiman, Wayne Rooney, score two goal, as Manchester United bilala Bayer Leverkusen 4-2 for de fes match wey dem go tap for Europe since dia forma coachi, Alex Ferguson, waka. Na Ferguson bin carri Manchester United win two cup, and he bin dey look as Rooney, Robin Van Persie and Antonio Valencia score all de goal wey helep dia new coachi, David Moyes, colet hin fes win for Champions League group stage. "I don tok am bifor, say Wayne Rooney fit join de ogbonge playa of dose days, wit de way hin dey score goal. He for even score three goa sef," na im Moyes yarn amebo afta match finish. De two goal wey Rooney don score, mean say na 200 tines hon don helep Manchester United score goal now. "Robin Van Persie goal sef, na helele. If we fit do make de two of dem dey score, we go show all man pepper." BANGA DEY RIPE Strika, Edinson Cavani show say de money wey PSG put ontop hin head, no be waste, as na hin score de fes goal for dia Group C match wit Olympiakos for Greece, even tho na Italo midfilda, Thiago Motta, shine pass, as hin score two tines. PSG tap ball sotay Zlatan Ibrahimovic troway penarity sef, as match enta mortuary time. Banga don dey ripe for Manchester City sha, afta de las two tines wey dem don play Champions League ball, even tho dem dey spend money like san-san, to buy playa. Na bicos of Champions League waka, make dem carri dia new coachi, Manuel Pellegrini come, and na Edin Dzeko, Yaya Toure and Sergio Aguero score dia goal. "To waka go anoda man house, win, no be small tin," na im Pellegrini tok. Na Pellegrini bin carri Malaga reach kwata final las season and he tok say: "Dat three point fit helep persin reach nes round sef." Benfica don carri Champions League cup two tines bifor, and na 2-kondo dem waya Anderlecht sef, but Juventus hear am small, bicos na 1-1 dem follow FC Copenhagen play for Denmark. Real Sociedad neva play Champions League since 2003/2004, but na 2-kondo Shaktar Donetsk dash dem for Group A.
Posted on: Wed, 18 Sep 2013 11:36:13 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015