Dis morning I went to escort 1 of ma friends 2 de bus stop - TopicsExpress



          

Dis morning I went to escort 1 of ma friends 2 de bus stop 4rm ma haus wen I saw 1 clean beautiful galie kam out 4rm her Brand New Range Rover SUV crying, she dey kneel down dey beg one slim guy wey dey look like he never chop for months.The girl just dey beg dey cry dey follow the guy, she dey tell am say she no need money, she no need Brazilian wigs, she no want house or anything, she say she no even need the SUV all she want be e love, e kisses and e warm embrace. The babe just dey shout dey cry.When I heard these words my heart stop, my head spark and my brain burst,the guy no dey watch the girl sef, for there na him i say if this guy no dey value this girl den me right now i done find love be that oo, so a walk say a dey go chat this girl. But as ago close to am, one man just touch me for ma back wey he say Mr Man abeg no block the camera… na film we dey shoot. I faint
Posted on: Sun, 18 Jan 2015 19:42:33 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015