E get one particular restaurant wey I dey chop 4 G.R.A. E get one - TopicsExpress



          

E get one particular restaurant wey I dey chop 4 G.R.A. E get one oyinbo wey dey always come chop there too… Anytime dis oyinbo chop finish, he go shout ”Hey”, so I wonder wetin dey make am shout. I decided to chop wetin d oyinbo dey always chop so maybe me sef go shout too. When I reach d restaurant yesterday evening, I order wetin d man dey chop. Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am, but i no shout, I collect extra plate, but i no still shout. I say dis oyinbo na mumu o, why e dey always shout like dat now? Na then i just vex ask 4 my bill. The waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then d extra plate too na another N75,000. Na then I shout hey! heyy!! heyyy!!! ……!!!! heyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy....#GUD MORNING. https://m.facebook/profile.php?id=544298819013669&refid=48
Posted on: Mon, 30 Jun 2014 06:16:08 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015