E get one restaurant wey I dey chop for ibadan, one oyibo dey - TopicsExpress



          

E get one restaurant wey I dey chop for ibadan, one oyibo dey always come there too. Any time dis oyibo chop finish, him go shout "heey!", so I wonder wetin dey make am shout.I decide to chop wetin the oyibo dey always chop,so maybe me self go shout too. when I reach the restaurant yesterday, I order wetin the man dey chop, dem tell me say na chicken and red wine, so I chop am. I surprise say I no shout, I even collect another plate, but I still no shout. na then I just vex ask for my bill. the waiter tell me say one plate of chicken and red wine na N45,000, and the extra plate na another 45,000. na then Icome shout "heyyyyyyy"!!!"heyyyyyyyy"!!!"heyyyyyy"!!"heiiiiiiii".... till I reach house I still dey shout... even as i de type dis stori I still de shout.. Hapi eld fitri 2 u muslims ... Abeg mak unano shout Heey ooo. Am honoured to be a participant of this year convention and a partaker of the blessing and glory. Good evening
Posted on: Sat, 10 Aug 2013 21:42:11 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015