Ejiro was asked to complete the following in an exam: Ques.1; "He - TopicsExpress



          

Ejiro was asked to complete the following in an exam: Ques.1; "He who fights n runs away"? Ans; E don surrender be dat nah, na fear catch am. Ques.2;" A rolling stone"?... Ans; No fit just dey roll, na person push am. Ques.3;" He who lives in a glass house"?... Ans; Na rich politician wey em be. Ques.4;" A stitch in time"?... Ans; Dey prevent further tear. Ques.5; "Birds of d same feather"?... Ans; Na d same mama born them. Ques.6; "One good turn"?... Ans; Na correct power steering fit do am.*nerd* Ques.7;" A bird in hand"?.. Ans; Wetin e wan be again if nor be barbecue. Dem plenty for chicken republic. Ques.8; "Half bread is better than"?... Ans; Puff puff, buns or garri without sugar. Ques.9; "A journey of a thousand miles"?... Ans; Na d person wahala be dat nah, Why e no enter car or airplane waka. Ques.10; "He who laughs last"?... Ans; get brain problem. Make dem examine am because na begining of madness be dat.. Ques.11; "A patient dog"?... Ans; Don get disease b dat. Na hunger go kill am straight. Ques.12; "All work and no play"?... Ans; Na bank job ooo bros Ques.13; "An apple a day"...? Ans; Na hunger go kill u jeje Ques.14; " Once beaten"...? Ans; Na revenge go follow b dat Ques.15; "A fool at forty"....? Ans; U never see Naija own, ours na at 70 Ques.16; "A friend in need"...? Ans; Na parasite em b
Posted on: Wed, 09 Oct 2013 18:29:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015