...FLOOD GOBE!!: For OGUN STATE, WATER DON CAUSE KASALA for de - TopicsExpress



          

...FLOOD GOBE!!: For OGUN STATE, WATER DON CAUSE KASALA for de AREA. Flood! Flood!! Flood!!! For Naija. Make dis fin no cause something else o. For Ogun state, plenti pipu wey dey stay for de Ogun Waterside Local Government no fit make am to Ijebu Ode onto de heavy flood wey dey dere, na de rain wey begin dey fall on Wednesday till Friday morning cause de Gobe. De flood take over de bridge for Igele-Ologbun road, con make movement for dat side dey somehow (ogun waterside) As ih take be for de area, pipu yan say nobodi die for de flood but one car enter de flood. Pipu for de area dey appeal to de government make dem find lasting solution to de ogbonge flood for Igele-Ologbun road. Some of de pipu trowe blames for de government say dem dey insensitive to dem plight, say de government no even dey send dem at all. As de place take dey somehow, if you gat waka pass you gat no choice but to roll ya trousers, skirts, even for dere pipu wey dey pass gat to pull off dem shoes so dem go fit waka pass wella for de flood. Cars self no gri pass for de area make dem car no sink go. Last week we bring una de news wey flood cover some area for one university for de area now ih don enta some oda area for de state. As ih take be so, de pipu dey beg de government make dem come to dem aid and do something shapaly so ih no go cause something else. ¤OGBONGE NAIJA¤
Posted on: Sun, 29 Sep 2013 14:11:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015