FULL EDITION Chemisluv PIDGIN PROVERBS (1)A bird in hand, wetin e - TopicsExpress



          

FULL EDITION Chemisluv PIDGIN PROVERBS (1)A bird in hand, wetin e wan be again if no be barbeque (2)Half bread, is better than buns or puff puff (3)D journey of a thousand miles, O boy beta make u go airport go enter aeroplane. (4)The patient dog, Na hunger go kill am. (5)All work & no play, Na Banker be dat. (6)He who laughs last, na mumu, why im no catch d joke d 1st time & laugh when others dey laff (7)Pant wey slack na im dem dey call boxers (8)When monkey wear canvass enter town make we know say im get plans (9)Na determination dey make okada rider overtake trailer (10)Pickin wey say him mama no go sleep him self no go sleep (11)Fly wey no dey hear advice the follow dead body enter grave. (12)Cow wey no get tail na God dey help am drive fly (13)No matter how u go under water go mess the gbudu-gbudu must come out. (14)Bullet wey meet face cap no be warning (15)If hand shake don pass elbow na fight. (16)Fowl no dey fumble for where pepper soup dey. (17)Na lizard wey no get sense dey boast for crocodile. we av more fascinating posts and updates @ Chemisluv page kindly click on => Chemisluv page to get more joke..........
Posted on: Thu, 12 Sep 2013 15:31:16 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015