For ur relaxation. My Blackberry don chop my money tire, na him I - TopicsExpress



          

For ur relaxation. My Blackberry don chop my money tire, na him I come vex yesterday sell am, come take some money buy Chinaphone! The phone get TV, Touch screen, Nail cutter, Fire lighter etc. I fit write Text message with toothpicks sef. But now am in bigger trouble!!! 1. E go full after 3 minutes of charging. 2. The spellings get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-pon, samswag etc. 3. When aeroplane pass, e go record One missed Call. 4. When a big car horn; e go show Charger connected 5. When Chinese man pass, e go show: One Bluetooth device found 6. When fine lady waka pass, e go show WiFi On 7. When ugly lady waka pass, e go show, Virus detected Abeg ooo! I wan sell am! Who wan buy ooo? Even as I dey find buyer, e dey show me for screen say No contacts found hope u all good v missed u!
Posted on: Mon, 19 Jan 2015 11:23:50 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015