*******GREAT NIGERIA - TopicsExpress



          

*******GREAT NIGERIA STUDENTS******* #RAMBO_IS_BACK #RAMBO_RELOADED #WHO_MISS_ME #UNA_GOOD_MORNING --------my fellow students,both does wen dey holiday and does freshees wen dey skul RAMBO greet una oo,hope say everybody mata legit.. me and my crew go on small break before,as our technical system be get small fault,but we don resolve everytin now,make una nor too vex for us..we son come back fully LOADED naw to dey slap una ears with COMFIRM MATAS wen dey sup for our GREAT AUCHI POLY,and around the town too.. #SATURDAY_NOVERMBER_22_2014_LIVE_NEWS -------Yesterday evening wen some our crew members dey do endurace treking go inside town,as dey pass inside skul make d journey for short small,nai dem see say people gada for notice borad wen dey near main gate for campus one,wen dem check wetin make dem gada,dem con see say school don paste HND 2ND BATCH,and ND 4TH BATCH,dem con ping me for 2go make I come as I reach dre d crowd nor be here oo,na so d name for HND many,but ND own nor many,and na some department dey self cos managment say some don full,we dey expect anoda list for both HND and ND,so hope still dey for una wen neva see una name,make who know person go meet who he know now oo,..na so my grand papa senior broda call me say make I check he name for hnd elect elect,I check am he name dey,nor b small groove we groove yesterday oo...congrat to does wen dre names come out like my grand papa broda.. ------Spat form wen dem start to sell last week go continue on monday,many pepole just dey ball in the town to buy the form,we dey hear say na CBT screening dem won do,but we neva confirm am yet,dem neva sitll fix date for the screening,but we dey suspect say na january dem go do am,but anyhw e b we go still tell una.. -------we don confirm say LECTURES don start for our freshees since on monday,,so who neva don screening,make he con do o,make una resume class on time o,make dem nor go write test leave una.. -------Yesterday our SISTER UNZIk do dre matric,na so our ogas and madams @ d top full dre,dem con say d student go start to use compus 2 next year.. -------CONGRAT to our madam @d top,madam rector as FG DASH her 2years join her ternor,so that she go continue to do her correct work for d school,mama we greet your bank account balance ooo.. -------skul management don say make dem start to sell hostel space o,but some people dey use the tin dey learn how to do market,as dem go buy am with small amount of money,dem go con dey sell am costI beg make una allow students buy oo.. ------SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 I beg make evertybody pay dre skul fees by dre sell oo,make boiz nor go use una moni take flex dre babe for chrismas oo. ------Abeg does of una wen dey come d town for d first time make una shine una eyes oo,nor allow anybody use ur head oo -------who get anytin to sell and who need anytin to buy make d person inbox me becos hungry buyers full ground o.. *****na here we go end today news make una add us,and join our group chat. cos na dre we dey first dey drop news and alerts oo,our group link na---https://m.facebook/groups/339734979504610 click d link and click jion we go accpet u sharply.. _____f u get any question,or need our help make u call or whatsapp--08059003932 #NA_AUCHI_POLY_RAMBO bring una dis package oo,,make I call my idegin babe make she bring food for me,omo dis babe won use love and njoymet kill me ooo...
Posted on: Sat, 22 Nov 2014 09:41:33 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015