HABA SIS, SLOW DOWN NA sis which one u dey sef u de fix fix - TopicsExpress



          

HABA SIS, SLOW DOWN NA sis which one u dey sef u de fix fix hair, fix eye lashes, fix d main eye sef u de fix nails, fix teeth, fix ur bum, fix ur skin color i even hear say u wan fix ur inner chambers, d oda day i hear say u meet ur mama for road n u shout mummy! ur mama look u well well and say, my pikin do i knw u? i never see u before o! chei! Wat if u get missing,hw do u expect us 2 find u? . u u look lile Beyonce for FACEBOOK, Niki Minaj on WHATSAPP, Genevieve on TWITTER and Mr Ibu in real life, i hear say even chameleon de jealous ur capacity to change sis, if u get lost na who we go find? U, Beyonce, Niki, Genevieve abi na Ibu abeg sis slow down, no let ur problem become we problem o u say u wan marry real man, hmmm, no make person pikin come pay dowry for Genevieve carry u go house see say na Ibu o! sis, slow down n BE YOURSELF, na so God want am o.... Culled.
Posted on: Sat, 29 Mar 2014 20:55:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015