Halo ma ppl. I dey troway greetings 4 una dis cool morning. D - TopicsExpress



          

Halo ma ppl. I dey troway greetings 4 una dis cool morning. D matter wey dey ground naa gidigbaa lk Rock of Gibraltar na ASUU( u sabi am already naa). Ehen wetin I wan yarn 4 d matter be say govt. no dey luk una face till una do one ogbonge tin wey strong kakaraka. I hear say dat aeroplane boy don get personal security. So all stdnts wey dey out dia, airline plenty o. Just go hide for one kia kia govt go notice u. Ehen! Sometin hapn day b4 yesterday wey mk me cry tear wey my neighbor tk baff. Na dose heartless ppl wey call demself city come dismantle my united lk say na joke. I tink say na play dem dey play till number 4 enter. Anyway united must rise 2 the game. City must pay. Yes, e get wetin I wan yarn tey tey bt NEPA no gree mk I yarn am. No be 4 dis Anambra dem celebrate 3 wks of no power failure? Wetin come hapn naa? Nawa o, if na lk dis mk dem no dey do dat kin celebration again o. Children of nowadays nawa o. Ask me wetin hapn naa. I dey waka 4 road come meet one pikin lk dat. I ask am how e dey, e no even talk come show me 5 fingers. Na slap I take Discombabulate im face, I sure say im mama go run wen e see am. Some tins hard 4 dis world JAMB na one of dem, bt 4 person wey get IQ of 199 lk me na small matter. Dat na why govt declare me wanted wen I smash am 399.99. Chai, I see gobe d oda day. As i enta club, I come see one cute babe lk dat, as guyman wey I be, I walk straight to her come introduce maself. She no talk, I tink say na forming she dey form. I come offer her dance, she gree. As we dey dance, she come open her mouth d kin odor wey comot carry me troway inside my car. Babes abeg o no kill person. Oya naa, e be like say I go apply am 4 brake here till I terribly jam una again. Remain enjoyment.
Posted on: Tue, 24 Sep 2013 09:14:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015