Heeeyyy mekuna help me wooo!!! Blackberry don chop my money tire, - TopicsExpress



          

Heeeyyy mekuna help me wooo!!! Blackberry don chop my money tire, na im I come vex yesterday sell am, come take some money buy China phone! Now am in bigger trouble!!! 1) E go full after 3 minutes of charging. 2) The phone get TV, Touch screen, Nail cutter, Firelighter etc. 3) I fit write Text message with a toothpick sef. 4) The spelling get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-Indecency, samswag etc. 5) When aeroplane pass e go record One missed Call. 6) When a big truck horn; e go show Charger connected . 7) When Chinese man pass e go show: One Bluetooth device found.  When fine gal waka pass, e go show Ur favourite food found. 9) When ugly gal waka pass, e go show, Virus detected. Abeg I wan sell am! Who wan buy ooo? Even as I dey find buyer, e dey show me for screen: No contact found. Have a pleasant evening...!
Posted on: Thu, 31 Oct 2013 04:56:14 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015