I LOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless Nigeria!!! Na only for - TopicsExpress



          

I LOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless Nigeria!!! Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship. Then Airtel go come follow say, recharge N100 and win Benin Republic. Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria bcos their colour na Green. Na only for Nigeria you go see fish insideMEATPIE. Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey sey:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (what a pity). Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me. Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC 4 Police station. Na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be BillGates? Abi na you invent internet? Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer. Na only for Naija u go buy coke, dem go say make u no forget to return d bottle. Na 4 only Naija, you go see madman dey control traffic, people wey their head correct dey obey... Na 4 only Naija, wey you go see the president senior the country herself. Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money. Na only for Naija u go wish somebody happy birthday, he go answer same to you. Na 4 Naija obituary poster dem go say MAMA HAS RELOCATED. Na 4 dis country Lawmakers de climb fence and Police de fire teargas at big men. Hey Naija! I am proud of dis my country we dey unique. I take God beg u to circulate dis message to reach every body to love dis nation. #Magnificentx :-D
Posted on: Sun, 28 Dec 2014 18:51:37 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015