I went to warri recently if you see name of churches, ha! my - TopicsExpress



          

I went to warri recently if you see name of churches, ha! my broda even Satan self dey fear. Make I yarn una.. Dat cool eveninq i jez say make i stroll qo down waffi town, Oboy, i tink say na joke when i see something like . . . . {1} SATAN UR OWN DON KPAFUKA EVANGELICA MINISTRY {2} Operation carry devil nack for ground bible ministry. {3} The atomic bomb bible brigadia barack ministry *aka* shoot d devil make im eye clear. {4}Satan wetin we do you evangelical church of God.*aka* Satan leave us alone. {5} Operation no look Uche face biblical church of Christ.*aka* slap Satan face ministry. {6} Pay your tithe and offering church of God.*aka* pay ur tithe n win generator gospel. {7} Satan if you try me, you go hear mween prayer ministry {8} Satan chop make i chop bible assemble *aka* we no dey find Satan trouble ministry. The next name shock me no be small . . . . . . . Boko haram prayer ministry a.ka. devil u go fear fear. . . . . . . , I no knw the time wey i take use leq run reach laqos o
Posted on: Wed, 13 Nov 2013 12:30:32 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015