If u see my mama....ayamma Tell am say o........ayamma That i - TopicsExpress



          

If u see my mama....ayamma Tell am say o........ayamma That i dey for facebook......ayamma And nobody wan chat.......ayamma Facebook don spoil......ayamma Na so so photo......ayamma Nobody wan chat......ayamma Small pikins don full am......ayamma Wey dem no fit write......ayamma Some no go school self.....ayamma Na so so photo......ayamma Dem dey borrow cloth snap......ayamma Borrow shoe snap......ayamma Evn borrow artificial hair........ayamma Take am snap......ayamma And put for facebook.......ayamma Facebook don suffer.........ayamma Virus don enter.........ayamma E no sweet again........ayamma Dey don spoil am.........ayamma So if u see my mama........ayamma make u tell am o........ayamma Dt i dey facebook........ayamma But e dey boring..........ayamma Abeg make un sing.......ayamma Sing again.......ayamma Ayamma ooo.....ayamma Facebook don tire me......ayaaammaaaaaaaaaaaa!!!
Posted on: Fri, 21 Nov 2014 20:03:27 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015