LADIES.......make una open your to ears wide open and hear wetin i - TopicsExpress



          

LADIES.......make una open your to ears wide open and hear wetin i wan tell una as e be say una no dey understand english, I go talk am for pigin... NOTE: Na only pidgin make una take respond. No be every man wey de drive car get money. Some of dem be driver, sum na their papa car, sum na their friend car, sum na their neighbor car, sum even steal the car sef. Becareful make them no catch you inside car with armed robber bcos na only man wey get car you wan follow. Marriage no be by force, if man say him no wan do again, make una no threaten to kill am. Like that woman wey chase her bobo with knife enter police yard, now na kirikiri she dey chop meal. You say you no fit follow small boy, Shey you don 4get say dat aristo wey you dey follow today na small boy him sef be yesterday. No de look down on those bobo wey de toast you today, you no know wetin dem go be tomorrow. No be every girl wey stand for road be ashewo. If you open leg because you de expect Brazilian hair, blackberry ,gucci bag, prada perf or pocket money after the action, you sef be ashewo! Try de take yourself out small, even if na mama put.That way una no go dey order like Oliver Twist wen him carry una commot. De try spend small for your man, no be say na just to de collect from am una sabi. No think say all boys wey toast you come for marriage. Dey wan study you before dey for fit talk of marriage. Man wey de find wife no go take you serious if you put pancake for you face like drawing board and wear cloth like say the material no reach. Na only boyfriend you fit find with that kin look. If you wan marry, begin dress and act like wife material no be like ashewo for allen....you no need for advertise your body...belive me the man dem know how it be... You sef de try buy small small thing for your man even if na small body spray. Shame no dey catch You if na just to de collect from am.... Make you uphold you dignity and no let one raggedy useless bobo come de talk to you anyhow cos him de give you chicken change.... You are beautiful, fearfully and wonderfully made in the Image of the Almighty...no sell yourself short joooo! ABI U NO NO!
Posted on: Wed, 06 Nov 2013 07:20:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015