LAGOS STATE NIGERIA > The largest city in Africa. > The city - TopicsExpress



          

LAGOS STATE NIGERIA > The largest city in Africa. > The city with the longest bridge in African. > The city with the largest population in Nigeria > The city with the largest industry in Nigeria. Also > The city were you can buy cooking spices while on hold up. > The city were u can even eat better Akpu with Egusi soup while still on hold up. > It remain make dem dey adopt pickin for inside hold up and make dem dey sell casket too. > The city u can be sure of staying at hold up for five six hours. > The city were dem dey read 419 4 skul com graduate with B.Sc. > The place wey be say if you no keep food for de rat wey dey ur house commot de rat go call u 4 phone tell u say him dey hungry, nd if u make mistake telling say food no dey him go chop ur certificate wey u take graduate. > The city wey rat dey get body pass oga wey get house. > The city wey Police dey fear agboro pass thieves. > The city wey all the girls you saw in de street go tell u say she dey skul and de guys go tell u say dey be businessman and manager of shell. > The city were beggars dey wear suit with tie. > The only city were blind man go reject fake note. > The city were you go give beggars money collect change from him hand sharp sharp. > The city were guys go first father two to three kids before he will get married. > The only city you can enter bus with N 20. My people abi I lie??
Posted on: Tue, 05 Nov 2013 21:28:07 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015