Lasisi Olatunbosun Wrote: This Morning I Just Dey Escort One - TopicsExpress



          

Lasisi Olatunbosun Wrote: This Morning I Just Dey Escort One Of My Friends To The Bus Stop From My House I Come See One Clean Beautiful Babe Comot From Her Brand New Range Rover SUV Dey Cry, Dey Kneel Down Dey Beg One Hungry Looking Bobo Wey Be Like Who Never Chop For Months.The Babe Just Dey Beg Dey Cry Dey Follow The Guy, Dey Tell Am Say She No Need Money, She No Need Brazilian Hair, She No Want House Or Anything. She Say She No Even Need The SUV All She Want Na Him Love, Him Kisses And Him Warm Embrace. The Babe Just Dey Shout Dey Cry. When I Hear This Words My Heart Stop To Dey Beat, My Head Spark And My Brain Burst. Meanwhile, The Guy No Send The Babe, Him No Even Look The Babe Side Sef, Na There Me Vex Say If This Guy No Value This Babe Well Right Now Me Don Fall In Love Be That O And I Go Claim The Babe. But As I Near There, Na So One Man Just Tap Me For Back Say Mr Man Abeg Shift Make You For No Block The Camera … Na Film Dem Dey Shoot!..... I Just Faint! I For Say! Na Only For Africa Magic This Kind Thing Fit Happen.
Posted on: Wed, 29 Oct 2014 15:02:09 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015