MOSOGAR E/W L.G.A DELTA STATE MUST - TopicsExpress



          

MOSOGAR E/W L.G.A DELTA STATE MUST BETTER. 10-07-2014 #featured ONE. UPDATES..... My people, as i dey write on this update tears dey flow from my eyes, i nor fit bear am anymore, i don keep this words tire, nai make me dey give ona so. My people see This great, bright, peacefull and Destined land of before don dey cover with darkness My people see Mosogar wey be one of the most peacefull town before them gain there freedom don turn war zone. Every day nai the rate of poor leadership dey increase for the town, every day nai unwanted things dey happen. And i don sit down think am well say wattin dey cause all this wahala na the Bad and Greedy Leaders wey we get And i don also think am say how we go take comot for this Darkness wey we dey now na peace, unity, progress and Transformation. After all this one, i cun sit down think am say how we go take gain all the good virtues wey go make us shine again. Well i nor fit shout, but the only thing wen i know say now na hw we go take make this kingdom grow pass as he be before ? Na peace. So as to say me and my fellow indigine don tire for Every-day case, H.R.M Samson Imoyin Omene J.p. I must call ur name because na u be our Royal father and number one man of this kingdom, abeg make you leave all those ur Vices wey dey cause wahala for d town so that we go fit grow. Chief Joe Orode Omene J.P. D Ist Dept. President Gen. U.P.U i greet u, abeg make you try forget and forgive all those things wey dey make u vex for the town, na settlement we want, we don tire for enemity, how we go dey live in war for inside this small corner kingdom wey nor reach half of Oghara. Chief Ighoyota Amori J.P d Otota Of Mosogar Kingdom, abeg make u nor mind ur political position, make u serve as an example for the town, make u 4get enemity and call for settlement. With all this, i knw ave been able to say my mind. Frm every nonsense u get sense. God Bless Mosogar ~TAFIA NETWORKING GROUP~ SAYING THE TRUTH.
Posted on: Thu, 10 Jul 2014 17:23:32 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015