Mede mede Xtra My people we salute all of una wey dey follow - TopicsExpress



          

Mede mede Xtra My people we salute all of una wey dey follow make the #MedeMede Republic tanda gidigba for Sports Radio. My people As the sentencing of Oscar Pistorius still dey shele dis week tori wey come out from South Africa yarn say Reeva Steenkamp papa and mama bin dey collect kpogiri from the man wey kpuff their pikin. Dem gree say dem collect £6,300 from Oscar Pistorius sake of say things hard for dem financially but dem say dem go pay back the money wey the blade runner bin give dem to helep with living expenses. Tori say dem collect monthly payments wey reach £345 ($550) from Pistorius from March 2013 go reach last month. My people na wetin una feel about dis matter so? E dey right abi wetin? oya make we yarn.
Posted on: Thu, 16 Oct 2014 13:46:56 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015