Mede mede xtra My people we salute all of una wey dey follow - TopicsExpress



          

Mede mede xtra My people we salute all of una wey dey follow make the #MedeMede Republic tanda gidigba for Sports Radio. Fifa presido Sepp Blatter don come out to confirm say im go stand for fifth term as FIFA president next year. Even though say yarn for 2011 say dis tenure wey him dey go be im last, e don come out to say e go run again for office. UEFA presido Michel Platini bin announce last month say him no go stand for the FIFA post. The 78-year-old say im go officially inform the FIFA executive committee of him plans for the next meeting wey go shelle on September 25 and 26. My people how una feel say Blatter don perform so far since dem elect am for 1998 and shey e deserve to run again for 5th term? Oya make we yarn.
Posted on: Mon, 08 Sep 2014 14:09:13 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015