My country people una welcome to Johnbull na mumu Tv aka Nothin is - TopicsExpress



          

My country people una welcome to Johnbull na mumu Tv aka Nothin is Real Tv of d year 2014. Our news dis week be say: THEM DON CHARGE ONE MAN GO COURT: Now d news in full. Them don charge one man go court sake of say he nor fit feed he family according to d IPO of d case he say d man get twenty children and na only one room dem dey stay, d man senior pikin when be 17yrs com talk say wen night reach all d children go sleep for ground and na one pant (under wear) d family get who first wakeup dey wear am. The court com ask d father watin he go do for d matter wen dey ground so. The man com bring out food times table he com talk say from today the family go dey follow the times table for feeding. He say monday morning d family go eat shew stick and water in d afternoon kola and groundnut and in d evening akamu(Ogi) and agidi, Tuesday morning all d children go com out for vitamin D in d afternoon sleeping competition in d evening sit and look each while wenesday morning dem go soak garri drink d water wen dey on top in d afternoon dem go drink d garri in d evening dem go lick plate Thuesday morning Yam and tea in d afternoon go out for visiting and in evening dem go play card who win go drink one bucket of water. Friday morning dem go check for obituary posters in d afternoon dem practice in d evening dem go show, Saturday morning Sanitation in d afternoon sport in d evening carry ur books and read Oliver Twist novel is compulsory .Sunday morning church service in d afternoon fasting and prayers in d evening dem go watch NTA news line. D family say dem nor go ever follow d food times table d father say he nor go ever change d food times table until he get new job, court don carry case go d next sitting.Pls always join us almost same station and always on facebook. Una doo oh
Posted on: Sat, 15 Mar 2014 14:07:20 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015