NOON NEWS/UPDATES. Report fly enter our studio dis morning - TopicsExpress



          

NOON NEWS/UPDATES. Report fly enter our studio dis morning say Engr Orukpe (wear sky blue native) gada all the VIGEO POWER LIMITED staff, as e address dem. During the address, e issue letters of Sack and Retainment to some staff. As we dey file dis report so, some of the staff dem don leave d work kpatakpata. Army and Civil defence corp dey d ground. We go feed unu with d names of those wen d new company drop and dos wen dem retain, so dat unu nor go fall dagbo to some wen dem sack. SSS cum carry Chief Barrister Hudson Orhorho and two other persons go Abuja dis morning. As we dey talk so,dem dey on their way to Abuja and we norva get d full details of d matter. We dey try to reach Barr Orhorho but d calls norva go through. Ecobank unu dey remove N1,000 from unu customers account say na for ATM. Nor be only one person dis tin dey affect,d tin affect pass ova a hundred of thousands customers wen dem remove dis money from dia accunt. Now e don reach 2 mnths dem neva send d Atm come , dem go say make pipo come today,come tomorrow . As I dey follow unu dey talk so, sombody apply 4 ATM yesterday for 1st Bank and e get am. I come dey wonder say na wayo be dis frm Ecobank against deir customers. (Mak unu share dis post till CBN and EFCC go see am.) Ganro wife don receive Freedom. She cum yesterday, wen we reach her to interview her,d family nor allow us go inside d compound due to security reasons. We dey celebrate wit d family and we dey call on Mrs Ganro to run go Warri go see her mama wen get partial stroke. 2 Area boys Akpocha and Asumosur go dey fight over some money wen dem make as dem dey collect gallant fee along side Jude a.k.a Bogger, Kekere oze, Snake Man wen be Asabodi youth chairman dey dere. D Ugbeyiyi Road don get 2 community, Asabodi community and Ebba Community. Ebba Community head na Obus Ebba why Asabodi na Snake Man Apiosu, na Adams Otimeyin nai appoint Akpocha 2 dey sign Well Bill bcos say dem be old child friends but Akpocha con dey side line Area guys make dem nor get deir chop 4 d Road nai make Asumosur wen be ex-Brorhen boy con send Eddy wen be e own boy make e fight Akpocha 4 dat road wen Sundoff School dey for back of Oceanic Bank 4 Malachy Junction na on Monday nite nai dem fight disgrace demselves. Army enter Shagari Cartel yesterday pack some men go and dem carry all d Igboo wen dem dey sell and the Dakar Drinks wen dem load for 20Litres. Dem beat many people for d area, as dem just dey catch anybody wen dey pass,dey beat. Unu wen dey Otite Rd i nor know who put dat Wood take cross d Road. If na speed braker unu wan do for dere, mak unu try set d wood well or mak unu remove d wood. Report also cum our Studio say na 2 pipo nai d Kidnappers free dis morning,as one family wen dey Ugberikoko Rd dey pour powder for neck,say deir person cum bak freely and notin happen to d person. We go nack unu d full tori later. We dey celebrate Barrister Ese Gam Owe wife wen dey incharge of Barr Ese Gam family. Dis woman na tipika Sapele babe wen get levels. She close eyes marry Man wen get big Children and she couple d man excesses and as we dey talk now,na Jeep be her smallest Car,also na she be d sole distributor of Red Lebel Drinks for Sapele. Dis woman get beta character and she dey hustle well. She nor dey find trouble and she nor join all those yeye Women meeting. Befor her Husband reach Houx,she don put foods for ground. She dey greet well well and she fine die. We use Omatsan Wife,Mrs Edward Carpe,Mary Owumi, Mary Ejele, Barr Mrs Atose and all d women wen dey sell Drinks for Decima Rd take wage Kola for you. THE WEATHER TODAY BE LIKE SAY HARMATAN WAN SHOW FACE NOW. ABI NA MY EAR DEY DECIEVE ME? MAKE I GO BUY MY OLI-COCO-DIA WEN I GO TAKE DO WET LIP DIS PERIOD. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 14 Nov 2013 11:54:58 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015