NOON NEWS/UPDATES. The Church wen dey Ogodo Rd extension near - TopicsExpress



          

NOON NEWS/UPDATES. The Church wen dey Ogodo Rd extension near Mission Rd, unu wan use drum take drive unu neighbours dis morning, as report reach us say d area pipo dey binu dis morning and dem almost cum interrupt unu service. Unity Baptist Church wen dey Ogodo Rd extension, make unu dey try dey give generously, becos the Pastor wen preach today just dey over talk, but yet unu heart still strong like Iron, to d extent say na Visitors nai cum dey give money to d Church and all unu just sidon like wood. Mrs Osimire wen dey stay Macpherson wen dey teach for my school na 50yrs today and she dance go church wit all her daughters. Na so all her children dey site like popcorn today. Report reach us say two Girls wen dey fight for one Bobo nearly rack dis morning for Hausa Rd by Market Rd, as dem almost use eyes take carry each other commot from ground. We dey tell unu two to behave, becos i nor wan call unu names yet, but if unu push me i go even upload unu pictures join. Hon. Apiam wife wen dress commot from House say she dey go Church nor enter Church today. Na outside she tanda put, as she carry one small pikin for hand dey blow old woman guy for outside near their House wen dey my land for Ziks field. Church Of God Mission wen dey Town. Unu 5 man security officers just sidon like jobless pipo and cars park anyhow for d compound. If unu wen dey do Church work nor ready, make unu drop unu offices. Most especially Mr Friday Esaghare. Security and Trafik control Unit of Oghenetega Baptist Church, I use d center parting of my yanch take clap for unu as unu tanda under sun today with plastic white chair for outside dey control traffik and unu eyes dey scan girls yanch. We carry yanch up take nack ground for Mrs. J. Ogbeni a.k.a Labelle International as she release one brand new Nissan 2014 Model with a customized number wen dem krest LABELLE put. Report wen land our studio be say, na her Children nai buy d car for her as her 60 yrs Birthday gift. One of Sapele Old principal of Blessed Memory LATE CHIEF IGBIGBI pikin dey marry today for Barry White Hotel, Ugberikoko. I don tanda for Room Q2Z, with my gbwa eye glass dey observe. TODAY WE ALL FOR STUDIO STAND TO WISH BABA T WEN DEY SELL COW MEAT FAREWELL, AS ONLY HIM JUST SLUMP FALL FOR E HOUSE, WEN DEM RUSH AM REACH HOSPITAL, D GUY MAN JUST GIVE UP THE GHOST. As we dey report so, the burial dey go on now. inaa lillaahi WA inaa illayhi rajioon Meaning to Allah we belong and to Him is our return May ur Soul Rest In Peace. Courtsey: Meat Buchers. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 09 Feb 2014 12:02:36 +0000

Trending Topics



The good wife. You
Black Friday Deal @@ C.R. Gibson Dena Accessories Wristlet Purse,
Un bărbat naufragiază pe o insula pustie și rămâne acolo timp
It seems that the issue with Scotland just starts. Very strange to
"Jesus Rode the Beast" Bishop Michael Cole; Luke 19:30-35 30
Congratulations J.O. Johnson High School & the entire #JagNation
Amy Matto Womens Sophie Dress, Olive, Medium 4ZIVA4 W9QLAA Casual

Recently Viewed Topics




© 2015