Na only for Naija you fit win Aeroplane by loading #200MTN - TopicsExpress



          

Na only for Naija you fit win Aeroplane by loading #200MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship. Then Airtel go com follow say, recharge #100 and win Benin Republic. Glo, go just say... Recharge 500 and win Nigeria because their colour na Green. Na only for Naija you go see fish inside MEATPIE Na only for Naija we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Naija PHCN dey say: Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (what a pity) Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Naija Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you u no see for Naija, you no fit see am anywhere in the world...?? Abi she I lie?
Posted on: Sun, 21 Sep 2014 10:31:10 +0000

Trending Topics



e front bumper, I
Farewell dua for Ramadan: Oh Allah this blessed month of Ramadan
Truyện 18+ : Dương Quá làm tình Tiểu Long Nữ Được

Recently Viewed Topics




© 2015