Nawaoooo... A guy will enter the bathroom to take his bath and in - TopicsExpress



          

Nawaoooo... A guy will enter the bathroom to take his bath and in less than 10mins hes out but Girls own dey different! Why should a girl spend over 45mins in the bathroom? Wetin una dey wash? Una they wash rug? Na the same thing wey dey una body dey guys own too na , but the reason wey dey make una tey inside bathroom like pregnant woman inside labour room still remains a mystery to me... Naso I dey one day my cousin say she wan go baff, na there I dey watch Legend of the Seeker season 1 finish and the girl still inside bathroom, hahan? Abi una dey clear forest join? But the annoying part is some girls after spending long hours in the bathroom they still come out smelling like Aboniki balm, wtf! So what the hell have You been doing inside the bathroom? The worst part is if You live in face me I slap You house and You have such girls as neighbors sorry be your name, them fit make You miss a job interview because them no gree comot for bathroom make another person enter... Nawaoooo really its not about staying long in the bathroom that matters its about washing the right places in your body especially your Armpit and hidden places where body fluids likes sweats accumulates.... Damn! #shouting nkechi! Nkechi!! Nkechi!!! Abeg come out na You don dey inside bathroom since 8:30am if I miss my appointment with Tiwa savage I will never forgive You!.... Sorry Guys no vex abeg, so as we were saying, its not Long but how well... Girls make una change abeg....
Posted on: Tue, 25 Mar 2014 17:41:10 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015