Noon News/Update PHCN Workers Union, both State and Zonal - TopicsExpress



          

Noon News/Update PHCN Workers Union, both State and Zonal level, don order say make dem lock- down all Sapele Biznex District Offices of PHCN. Dem still say make all workers stay at home, say dem nor go fit work for hostile and militant enviroment with militant pipo as Management. We report to unu yesterday about how the District Manager, Engr Orukpe go use SSS take treaten the Union Chairman. As we dey file dis report so, the upper house Union don order the Business Manager, Engr Orukpe to come their Zonal Office, say make he con explain why e send SSS go treaten d Local Chapter Union Chairman wen dem dey call Comrade Onofe wit gun before dem go consider d opening of d offices, bcos d safety of d workers nai dey impotant. Dis katakata don let some areas dey suffer light for d town since yesterday evening, up till now. Make unu make sure say unu nor pay lite bill if the light pass today. Ugbeyiyi Road by Barr Charles Obule compound don kpafuka finish and the pipo wey dey pass dere everyday don turn permanent customer to Mechanic. Dat route don finish Hon. Godwin Atose Honda and Crysler wen e use our money take buy. We dey call the Authorities wey dey incharge to continue their work as election don finish. Muslim all over Sapele tanda for Sapele Athletic Club dey say their Prayer alongside all other Muslims for the World. The Imam of Sapele Central Mosque nai lead the Prayer as other Muslim friend join dem to say the Prayer. Na so dem begin to dey shout Allah kobarò, eshu kobuko ( God dey front, while make devil go back) Federal Road Safety Commission attack one Mr Mike and one Lorry wen carry Wood for Koko Garage. But the Market people wen dey around cum out come beg the FRSC workers. Na so the FRSC pipo just laff muen muen commot. Delta State Govt don nack 3 Months grace not to arrest Children wen dey Hawk and wen dey Wander follow Town as some faithful parents go meet our Governor for Office say, make we sensitize our School Children and Parents first before we go take Law against dem. Report fly enter my studio through the MTN Mast wen dey supply Urban Area covarge say Yello! If u wan experience MTN latest data products, Hynet, and phones, dem dey invite unu to attend the MTN Data Fair wen dey take place now for number 31, New Ogorode Road Sapele (VIC FAST FOOD BUILDING), from Oct 14-18, 2013. FORTUNE wen dey work as Nurse for Jesus Heal Clinic, u get one fine son and u dey stay Abeke Rd after Remind Home, wetin dey do u sef? Why u dey use pipo husband dey do ur own? I give u 24 Hours to leave Kingsley Nwokafor wen do face like boa, alone. Kingsley don marry and e get family to take care of. Na since wen dem admit Kingsley Papa for dat Clinic since July 4th and e stay there over one month b4 e con die, nai u nurse FORTUNE dey date Kingsley. Because of u, Kingsley dey treat e wife like rag. Even e family don beg u to leave Kingsley, but u nor gree. If anything happen to their marriage wen norva reach two years, na u we go hold. And we go naked u flog publicly. And ur name for FaceBook na Merlina Kyle. And u Kingsley, na so, so skirt nai u dey smell dey waka, go take care of ur wife and ur son. Nor allow Fortune to destroy ur marriage with her bleaching face. Church of God Mission wen dey New Rd opposite dem Jude wen be kolo compound by Premium Fuel station, make unu try get pipo wen go dey control unu traffic during unu sunday service. Last sunday, dem jam one guy wen dem dey call Fouma Mecedez Benz C-Class. Make unu do sometin fast to avoid wentin oyibo dey call future occurance. We dey use dis medium dey solicit for Recharge Cards Anyone to upgrade some of our Machines due to subscriptions and health concern to some of our faithful correspondence. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
Posted on: Tue, 15 Oct 2013 11:44:19 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015