Noon News/Updates 11/4/2014 We troway 6 gallons of green - TopicsExpress



          

Noon News/Updates 11/4/2014 We troway 6 gallons of green water mix with ororo for ground as we burn 12 turable of incense take welcome all Celestial Church Of Christ Women for the whole of Nigeria as dem gada yunko-yunko for their Crudas Road Branch now for their 2014 National Women Convetion. We wish unu fruitful programme as we call on unu to include d development of Sapele join unu prayer points. We go donate 20 yard of China white clothe give unu as our contribution to unu programme. ahiba, mimo, Jesus Christ, mimo, Holy Micheal, mimo. Report slab enter our studio say, dat fat girl wen her name na Ogaga and dem dey stay dat Govt Quarters wen dey share boundary with Athletic Club for back of Koko Garage na hefty lesbian. Sometime back she and her close friend get qwanta nai dem begin disgrace and talk each other secret. D thing wen start their quarrel be say Ogaga get her own cream o but anytime wey she visit dat her friend she go press the girl cream rub and mendi for male attraction dey inside so d girl go dey vex say she don spoil am and to do new one go cost money. To cut long story short when Ogaga draw her eye pencil wen she prepare with almost N8500, she con say today na die! She say ogaga dey do am intentionally to spoil her work say she wan thief her luck. She say make Ogaga pay she but she nor gree as she dey form quarrel. Na so dem begin insult each oda as dem used words such as idiot! So so my luck u dey wan thief. Na so u use feferity take collect Dora from my hand only two weeks wey I go Asaba. Yeye girls. Report wear mukasin enter our studio say, around 8:06pm last nite for front of Oluwa Lambe for Abeke Road. One yeye Police Patrol motor jam Okada with passenger, e be like say the Okada man lose control, na so another okada wen dey come for front collide with am. The okada come fall. This okada wen police jam so carry passenger wen dem wear white garment. Whether them dey come from church abi them dey go church i no know but the 2 passengers na female maybe mother and daughter the mama just get small bruise but the younger girl faint flat. To the surprise of the area people the stupid officer wen dey drive the patrol car dey wan make mouth, as boys for Oluwa Lambe guest houx plus d area people wan start to oppress the yeye police with abuse na so the police man use the motor discharge like say na hit and run, he no even send for the girl condition he just drive go. Na so dem take rush d girl go nearest location to receive first aid. Oga DPO na ANIMALISTIC Behaviour nai ur patrol team do yesterday. U beta caution dem b4 I go send petition go Abuja. Jossy for Reclamation wen worwor like Demonic Boa and e mama dey stay Christmas Junction dey sell pepper soup. Report use kite take land studio say inside dat him tiny kiosk where he dey sell kerosene near mama Evelyn Indomie store nai Jossy don turn to he charlet where he dey draw small, small children breast even children wey nor get breast e dey pam their breast like dat as he force dem to dey get breast when dem nova reach to get. He regular client na dat small girl wen her mum dey sell insecticide under dat upstair for d junction of Christmas Rd. Jossy, na jail dey call u so. Yeye odumitete Gbewun wey be cripple for Decima Rd carry himself go MercyLand for warri for healing. Even when dem call am out for alter, as one of d men of God lay hands on am e fall yakata begin speak in tongues wey sound like itsekiri mixed with Congo and Kalabari. Pipo nearby con dey laff even GBEWUN himself con dey laff. I just provoke for my mind say Wetin dey worry am. Abi he think say Mercy Land na playground. U wen dey work for Life Flour Mill account department, if u come work for morning try stop to dey do tatafo. U know ursef. U get mouth wen long like long mouth rat & na so, so lip nai u dey suck. Ur name na Madam Yetunde Ijadare. We dey inform d general public say some hospital within Sapele metropolis, record about 20% of HIV cases just now. As we dey update so, d survey show say about 16 girls for dis town don wrap their body with blanket of dis deadly deasese. Sapele Tafia Studio, through the Ministry of Health dey encourage everybody for dis forum to stop skin to skin with person wen nor be ur wife or seriousy. Make we dey apply d use of condom. AIDS, dey Sapele. THE MEMORIAL OF JESUS CHRIST DEATH. KEEP DOING THIS IN REMEMBRANCE OF ME.(luke22;19). The anniversary of jesus death falls on MONDAY: APRIL 14 2014 ,after sundown. According to Jehovah witness. So dem dey invite unu, to come listen to a brief talk on dat day. This free event go take place, @ The kingdom hall of Jehovahs witness for Sapele, after sundown. Unu can atend @ any kingdom hall. Hon Julius Okotie wen fat like oyibo pig don begin flag up under PDP for ward 7 councilorship. We dey watch. OFE WEN DEY CONNECT CABLE FOR IKOMI ROAD, UR MARRIAGE NA MAY 3RD BUT U DON GO TIE UR BANNER SO EARLY AS APRIL 7TH FOR OLYMPIA. NA KOLO GO USE DAT UR BANNER TAKE WRAP HE SORE VERY SOON B4 DAT DATE GO REACH. LOLX God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 11 Apr 2014 12:15:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015