Ogbonge Spanish La Liga club, Sevilla don announce on Friday dat - TopicsExpress



          

Ogbonge Spanish La Liga club, Sevilla don announce on Friday dat dem don sign Romania strika wey him name be Raul Rusescu and na even 5 years contract de guy sign for de club. The guy wey sabi tap ball well well from de wing go replace Jesus Navas wey don kommot for Sevilla as him don go sign for Manchester City for England. Raul Rusescu wey go clock 25 years ness month don helep Steaua Bucharest win de League title lass season as na him be de baba for gols afta him score 21 gols. Sevilla kon later tok say de contract wey Raul sign for dem include £40 million buyout clause, but de club no gree tok any other matta wey follow de guy transfer to Spain. Na dis week Tuesday na im Sevilla carry dia winga, Jesus Navas give Manchester City and plenty amebo tok don full ground now dat another strika wey him name be Alvaro Negredo fit waka ness week.
Posted on: Sun, 16 Jun 2013 06:31:57 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015