Ol boy e get as e be o. All dis one wey be say e be laik say - TopicsExpress



          

Ol boy e get as e be o. All dis one wey be say e be laik say evefritin don stand still. Small taim we hia say BH wan go drink Orange Juice for Aso rock, one BH begin harras armi offcer anihow. Na hin all di armi vex enta prison just pluck 18 terrorists and just shoot dem laik pesin wey don swallow 12 orange seeds, u know dose tiny ones - di tin no make sense. Case don close be dat. Pesin wey no be terrorist sef, die because of OJ, naija judgemnet no dey pass 3 seconds. Naija news tire me ojare, make we look wetin dey hapun for betta kontris dem. I wan go Japan sef, I hia say dem dey do betta Science studies - Na all of dem dey chop whale, come dey lie to all of us say na science. Small taim now, if earthquake come clear all di whale eaters we go dey halla. Whale wey be say di ones wey remain for dis world no reach 38. Na hin dose pipu dey dip insde katsu curry dey go - utsandiego/news/2014/mar/30/un-court-to-rule-on-japanese-whaling/ Dem tuk say na chikin wings dem take find Bin Ladin, say small taim when Yankee spies dem reach Pakistan, dem yankee pipu tuk say na Kentucky dem bin come from. Even sef na di Ken dem tuk before Omar begin point hand say na there!, no be say dem don even ask am any kwesion sef. Na KFC make America great o, no be Playboy - telegraph.co.uk/news/worldnews/northamerica/usa/10735747/Torture-was-not-essential-to-find-bin-Laden-US-Senate-report-will-find.html Dem tuk say bridge wan collapse for paris, becoe dem to laik women theguardian/travel/2014/mar/31/campaign-paris-love-locks-banned Everytim Jean Francois see woman tuk Bonjour Mademoiselle!, if she ansa he go go buy 2 padlocks, if she no ansa e go buy one, say hin don find love, and as hin padlock bridge, Moi cherie no go leave am, na dis one be remote form of magun, wey u go dey lock people togeda. Dem say unless pipu begin divorce now, now, dat bridge go collapse, say di bridge go collapse next week Thursday...even sef, dem tuk say di French first lady wey dem kick out of Palace laik palace kick inside Chelsea net, go buy 10...10! wetin dat one go do sef. Dose of una wey get two eyes, make una take one begin look germany o...dem don dey make moves, and dis pipu don start 2 World Wars alreadi. No be tuck, se na me tuk say make u no dey do history, even sef na crocodile I dey call dem. Small taim dem go tanda dey look all of una, when una tink say..Oga, oya make we cross road, now, e be laik say e don die.. Snap!, na so crocodile go swallow a whole village with dem palmwine - euobserver/foreign/123685 Me I don tuk my own finish, if u laik make u dey watch Chelsea dey chop serious beating from Crystal Palace. U fit watch dat one too ojare. China pipu sabi kill market. When everibodi dey look for place to go for holiday, na hin chinese pipu tuk say dey wan kill plane travel, no be say dem plane no work o. All of dem tuk say dem dey safer inside train. Even dose wey be say dem neva travel before, tuk say na train dem wan enta. qz/193556/chinas-high-speed-rail-is-so-popular-its-hurting-the-domestic-airline-industry/ Di gofment don tuk say dem go double the train ticket, but di pipu no wan gree. Na dis kin train dem build for naija wey be say na onli inside plan e dey. Aniway, e go betta sha. Before I finish my yarns sef, I hia say GEJ get girlfriend for Abuja, some say no be hin girl friend na hin waif, some say na mistress, some say na graduate..all sort of nonsense dey fli pass my screen sef, I don wipe am twice today already sef. Di tin me I wan tuk be say, until we see pikins dem, all na nonsense...di tin be laik pesin wey dent hin bumpa small, wey di mechanik look sotay de tell am say hin brake light dey expensive. Shuo! Oga notin do brake light abeg! na go I go so...
Posted on: Tue, 01 Apr 2014 14:42:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015