Open-eye Na Bad Tin Open-eye na bad tin Wey make Olorun purshu - TopicsExpress



          

Open-eye Na Bad Tin Open-eye na bad tin Wey make Olorun purshu Ofurukpe Comot from heaven cum earth He dey waka waka dey find Wu he fit put sand for hin eye He dey sell silver and gold If u buy u pay wit yor soul Fish sweet rat trap murder am Open-eye na bad tin Wey Ofurukpe tich Adam and Eve Na hin make Chi purshu dem Comot from de fine garden Death con fly cum from hell Evil hawk wey no get respect Come dey catch de hen And all dia children children children Open-eye na bad tin Na hin make we nor go farm Plant cotton, cocoa, n rubber Wu say Naija nor bi mey-ruwa? Na river deltans she dey fetch walta Na hunger wire man fall for gulta Comon plantain plus palm-oil Yam he nor fit buy chop Open-eye na bad tin Wey dey spoil our societi Na hin make Iyawo wear khaki Make Barawo nor tief ha Oga How mi wan take know na? Say she be marriya? To say she enter my eye I do wrong if I go colorbi ha? Open-eye na bad tin She nor fit dance kiri moh moh Na kukere-kukere she sabi She nor sabi siwe Even shokolokobangoshey she nor sabi eikor and etor Waitin she carry for head? Na me go tell u that one? Open eye na bad tin Mama dey cook for kitchen She dey pingi pingi her boi boi Wen nor go marry ha. My brother khaki dey fall But e nor fall reach ground Which kine hair he cut? Na my mouth u wan hear am? Open-eye na bad tin, Wey no get shame We don forget our name, We don forget our place, She kon paint ha face, Na ha mosquito lips dey fear me. Which persin blood she suck? If I talk am u go tell am? Written by Rex-Mayor Nov 9th 2013
Posted on: Mon, 11 Nov 2013 01:56:28 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015