P.M News/Updates. 8/5/2014 Report use Mr Galloway New Jeep - TopicsExpress



          

P.M News/Updates. 8/5/2014 Report use Mr Galloway New Jeep enter studio say the family of Tsano bury deir Papa today, as dem carry d corpse from Okparavero Memorial Hospital go our white garment church wey dey Ogodo Rd by Mission Rd. Before den dem carry the 93yrs old Apostle wey kpuff go e House. As i dey report so i dey go d wakekeeping for Ayetan lane off Mission Rd till day break. Who know say e nor get evening food to eat make e come join me as i wear Green Suit with Brown Pens for Blue shoe and Lemon colour waist coat and Yellow Papas cap with JOJO Amani Red wrist watch, i go sidon for 6 plastic chairs so dat unu go quick identify me. Report use Oyibo Ebosa latest Range Rover 2014 wey i borrow am take enter studio say the Sapele boy Pastor wey dey head d Christ Embassy wey dey Oghara wey e mama dey sell food for Ogodo Rd by Cementry Road wey dem dey call Zogie wey marry one slim girl. Dis Pastor dey doke one Girl wey dem dey call Ese wey her mama dey sell fuel and after d Pastor marry finish e own come worst as e nor dey use eyes dey see fine girl. Na so e dey spend fire for bearbear bank and e go dey form say e nor dey shit. Report use G1 motor wey nor get name take enter studio say Queen Alero Jakpa d current chairlady of Opio don dey sidon dey use her future dey play, as we nor fit count the men for Sapele wey don divide her two legs. Alero na black fine girl wey english dey hard to speak but she just dey use her kpekus dey do Oribotor dey follow Sapele and Warri. Alero change now becos u still young and ur Ukwu still stand becos time dey go. Report use Boyi Range Rover take enter studio say Boutique people hold meeting today for Fabulous Hotel and dem sworn deir new executives enter seat today,as Mr Frank wey dey sell for Boyo Rd emerge as the Chairman. The ceremony carry small flexing and d tin dey o.k but where i for vex for dem na where dem for say who go join the union go pay N40k, becos some people stores nor even get reach dat amount sef. We don dey compile names of married women wey deir Husband dey abroad and dem dey doke like native fowl dey follow the town while some dey play away runs. Make unu dey prepare becos unu nor go fit dey fool our brothers and unu dey collect foreign money dey cook for guys wey nor get unu time. ESE OSIOH! ESE OSIOH!! ESE OSIOH!!!. Amany times i call you? Na service of song nai use hand beat chest for Negburagho street today for Late Chief A.O. Obazee. No be small cry he senior pikin wey dem dey call Emma wey be doctor for Teaching Hospital for Oghara dey cry for there. Emma doh God knows best. On the 10th of May wey be dis Saturday nai be the final burial. D corpse go leave Oghara Teaching Hospital to he compound for Neburagho for a brief stop over, and then finally for to his home town, Idumiru, Igbanke for Edo State. R.I.P JOKPA. Report use Richy Starch cheap benz enter our studio say, Yellow Erigga Idahosa wen deir houx dey back of former Ikigho Store opposite Texaco fuel station for New Rd, she don turn World Trade Centre for Opio bizness. Na almost all d men of various ethnic groups for Nigeria nai don spread dat her isekpe wen nor get control. So tay she nor find again as she don use her beauty take fry garri. Try get sense b4 doking go use AIDS take act Glamour Girls Pt 6 for ur body. Yellow Eliza wey dey stay Gana wen be world debtor don dey doke small, small boys dey follow dis town as she don dey get doking branch for Oghara. Dis Eliza na tif and one guy wey she go pam he gold use prick take finish her life say make d guy nor talk, even wen she dey her husband houx. Eliza, u nid 14 Prophet TB JOSHUA to cast dat kleptomanic and igberajiz spirit from you. Juliet Ugbruwbrusi! Juliet Ugbruwbrusi!! Juliet Ugbruwbrusi!!! Amany times I call u? Ur gbwa dey near ur papa grave for Amukpe as u nor wan rest ur tiny hole so even after u don drop one engine, na me go put ur carry do for show glass take show d whole world. Wait and see. As Bishop Handel Adiren carry Liz Benson come Sapele to con minister so, my Studio don dey conclude plans to invite Toto (Tonto) dick (dike) to come d cartel wen dey by Wado so dat she go minister with ganja and weed for us. Lolx. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 08 May 2014 19:58:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015