P.m News/Updates. 15/12/2014. Report enter studio say na so - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 15/12/2014. Report enter studio say na so so Meetings nai Hon. Monday Igbuya dey hold follow town and na so Rice women dey gada for e gate everyday dey wait for deir December Food. Hon. Monday Igbuya dey back of Topclass yesterday with Okotogbo. Na only Hon. Monday Igbuya nai himself as na d TUNDRA e drive,why Eze drive d Hilux dem one other small car follow am for back. Report enter studio say e get one Guest Houx or Hotel for Jesse call wey dem dey call Edafe Guest Houx somtin bad dey go on for that place and i dey inform Army & Police to kip watch on dat place bcos most of d Girls,wen dem dey take go dere somtyms,na innocent passengers wen d so called guys use charms on,and dem fit cum go dey take something from the Girl body,we nor go know. One of us here na victim on Friday wen pass so. She come Sapele cum witdraw moni frm atm on friday evenin & as she dey board vehicle for Okirigwe garage arounnd 8p.m wit 3 young guys wen sidon for d back,base on say she nor get option of anoda car,she cum be d only Girl for d Vehicle befor she know wetin dey happen dese guys,wen pretend to be passengers tell d Driva to carry dem to d Guest Houx,till dem reach Jesse she nor be hersef,becos dem don blow charm.against her senses. Na the God of Shiloh wey she complete the programme well nai deliver her,as she lighly gain consciousness,nai she stop d driver begin run. And na Oghara be her destination. We thank God as i dey call on Security people to check that Hotel well. We all for studio hold our hands together,as we kneel down for ground dey thank God for the successful delivery of our friend Mrs Juliet Odum as she born Girl pikin for U.K some days back. We pray make God give u and ur Hussy the strength to bring up dis child up well,d way God go dey happy. Report reach us say one GH Burger wey dem dey call Edafe die yestaday for keke accident. The report show say Edafe park e motor for corner, nai he enta keke with he friend, as dem dey go nai motor quack d keke 4rm back, naso d keke samasult. Edafe die flat while he friend sustain injury. Na D.O.A (dead on arrival) nai be d english wey doctor take dash am wey dem rush am reach St. James Clinic. We hear say na recently nai Edafe Mama die and Edafe don kpuff join he mama. As we dey update so, Edafe remains dey cool off for mortuary. Report enter studio say bad things don dey happen for Amukpe over dat Nupeng Chairman wen die family. The younger sister of the man wen cum from Germeny nor let d wife drink water put cup down just becos d lady nor born for d man. This younger sister to the man just come, collect all d Car Keys and Documents, and d funniest thing be say the.man get son of 25yrs. This woman abi na Germanyman even say she abi na him i go use,say e go strangle d wife if she nor leave d Houx. Wey dis Germany woman u beta respect ursef and allow Elders of ur family to talk and decide before i go pour you acid perfume. I hear say dis Germany woman dey propose Biscuit and Groundnut for the broda burial reception. Report reach us say AMUKPE by OANDO FUEL station dey experience Government touch as our studio man around town rightly inform us say caterpillars dey work on d road as dem dey re-surface and smooth d already expanded road. We commend d work wey dey go on there as d road don dey motorable small. Aroma Foodland dey lead so far for Xmas decoration. Naso dis year innovation bam. D creativeness na fire. We raise yanch for dem, but their gutter dey smell. Lima Baby World wey be muslim still decorate her shop wit xmas colours. The tin make sense but who decorate am na mugu. RainOil, weytin unu dey wait? Nene Clinic wey manage decorate deir hospital get money reach unu? Okwakwa say make we grit unu from our studio. Unu wey nor dey kukuma dey baff b4, unu don c somewhere hang am put as we wish unu more odour to unu armpit. Report reach us say Emma Ugole wey dey confess witch for Ojolu don finally die today. B4 he kpuff, he lean like monkey sugar cane and he black like imiesa. He confess say he dey use he mama take dey do d do for egboran. He confess say he kpuff he sisters children. As we dey report so, Emma Ugole confess many atrocities wey he don do. Man witch dey hard to finish. Emma Ugole work as casual for NEPA Undertaking before and dem dey stay Ojolu near Paul Ojolu cartel. May his wizard soul burn to ashes. Amen. Report enter studio say one of us for dis forum lost her wallet yesterday,na red wallet containing her I.d cards,some money and ATM cards,Vanessa Ogbakpah nai b d name wen dey d cards. We dey beg anybody wey see am,make e try contact me for inbox make i contact the owner. Information come say make i helep share this Ogbonge opportunity (Free Training Seminar) wey don land for Sapele. YOMA A COUSELLING CONSULTANT FROM LAGOS, (Na member of Church Amazing*cgmi*) don dey Sapele now to emback on 3days training, this training go dey on different areas such as how to startup a Business with Small Capital, how to save Income, how to market ur Goods, how to motivate Employees, how to satisfy consumers e.t.c. The training na f.o.c (Free Of Charge). Outside this counselling summit,u as a CEO, Director, Manager of a company wil be charged for the fee of 60,000. 90,000. 200,000. 250,000 Thousand. But here comes this gr8t opportunity, NA FREE OF CHARGE OOOOO. if u dey interested just send ur name and gsm number to 08152696736. Make haste while the sunshine. Tel others too. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 15 Dec 2014 19:42:27 +0000

Trending Topics




© 2015