PIDGIN SECTION: Igbo Fit Kill Person Oh! I carry my two hand put - TopicsExpress



          

PIDGIN SECTION: Igbo Fit Kill Person Oh! I carry my two hand put for ground come raise mytwo leg up just to take salute every body wey dey smoke igbo.no be mouth, una too much oh. In fact, una dey another level of reasoning. Two friends go smoke igbo finish come carry the one wey remain dey go house so dem fit smoke am for morning. As per say dem don high na, the one wey hold the igbo for hand come stagger come fall inside swamp. As the guy dey sink na so him raise the hand wey him take hold the igbo deyshout“save the weed, save the weed”. Hehehehena so him mumu friend wey suppose help am just foolishly go where him dey, collect the igbo from the guy wey dey sink, come leave am dey go.Hohohohoho.Oboy ehn……na by the grace of God na him that boy no die oh. Ehhhm, still on the mata. Na so I take go my padi house wey dey do birthday. I chop all the choppables, drink all the drinkables, rock all the sweet 16 naso I wan come go house go sleep my padi wey I think say na my guy come tap me say make I come drink pepper soup for him room. My brother my sister, long throat no good oh, as I go there isee people wey dey sleep yet drink the pepper soup come demand for extra, before I know wetin dey happen I begin see stars and aliens on earth. Small time, e come be me like say I be bird and my hand come turn to wings. Omo’na so I take jump from the story building thinking say I go fit fly, only for me to land on top of the birthday cakein front of every body. Choi!. Na later my guy comeconfess to me say dem use igbo prepare the pepper soup, I wan mad! I no fit shoup oh! Abeg dey careful of wetin u dey chop because you case fit show for national TV. Ehhnnn; person dey call me abeg next time go better. Oya bye bye, bye garri.
Posted on: Thu, 22 Aug 2013 20:01:37 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015