PM NEWS/UPDATES 29/07/2014 Report reach our studio wey dey - TopicsExpress



          

PM NEWS/UPDATES 29/07/2014 Report reach our studio wey dey Okoloko Bridge say, e get one girl, she dey Okpe Road opposite International high school, she get one leg, she don finish Secondary school. E get another man wen e they work for Sapele clinic, he name na Mr Joshua, this guy dey produce Artificial Legs and hand for that clinic, this man con see this girl one day wen he dey pass with VEHICLE, he con stop, he call the girl say make she con make he produce free artificial LEG for this girl , she refuse to go, why? This guy con go meet the Girl mother another time again, tell her say make she bring her pikin come Sapele clinic, dem refuse to go, why? Wetin unu think say that family dey find? To dey beg money or to dey look for help? This guy don try he best to contribute to the Sapele society but dem refuse. I dey tell unu so dat make unu know say some good people still dey dis sapele. Make unu try ask dat girl and her family why dem refuse to go get that free LEG? The girl they use armpit crucht take dey waka, she dey attend EBENEZER BAPTIST CHURCH OKPE ROAD. MR JOSHUA, the PROSTHETIST/­ ORTHORTIST God go bless you. Report use 7 putting hand and one none putting hand throway backy enter studio say wen we just go break nai Omasan Mabiaku a.k.a Olololo enter World greatest female scammist Angelo Ebere Egede birthday party for Richard Continental Hotel a.k.a TM. As one smally wey come from Ghana GH just dey spray the Girl nai Omasan wey tall like Ayomanor statue,begin dey vex, say the GH Burger dey fall him Omasan hand. Na so Omasan begin spray Ebere yanch for public, dey throway money like say na Marriage dem dey do for TM. Dis na Girl wey Omasan and Winor Kelvin don use mouth judge anyhow say na bad Girl,yet u Omasan still dey golor dey follow her and u know say the poor Girl don finally hook up one guy,wey she dey remote. After the Birthday na D-Stone Hotel i for see married Omasan knee down dey beg one Girl. Like Oga like Boy. Report come from some Ex corper wey don serve for Delta State and Sapele precisely,as dem bring to my notice say Delta State Govt nor dey pay all Corpers their state allowances not until afta six months and eventually dem nor dey pay some till after dem don tru. Dem nor pay some persons for d last set wey pass out a dime and dem suppose to collect N5k per month wey sum up to be N60k a year. I dey drag my ear to the authorities wey dey involve to make fast adjustment before i go site tagba for deir body, becos na very evil act to dey divert he poor graduands money at that early stage,becos the last Batch A wen pass out Feb 13th na about 100 people nai nor collect allowee and many students don dey pray make dem nor post dem come Sapele and Delta State becos of dis matter. Report reach us say one beautiful thing and a great development don dey near Sapele,as we don dey see our younger football players from Academy 4 Stars Academy as dem dey display their Travel Visa to travel abroads for trial and many of dem don go Turkey. Dis na great opportunity wey one Mr Elvis Ewruje dey give to these great talented ones from Sapele. Also special thanks to Ejele, Hon Commissioner of DESOPADEC wey dey Itsekiri Kingdom, a great lover and player of football (ALL STARS FC, SAPELE), as e sponsor some of these boys abroad. Our studio regret to annouce the death of FLOXY IGINI nee ISIORO. Dis lady grow up for Laboard Rd axis of d town b4 she travel go Lagos go fly Sapele Flag. We pray make her soul rest in peace as we dey warn d family not to bury Floxy like fowl becos she deserve beffiting burial base on who she be. We all for studio throway belated congratulatory message to our studio diva,princess and ever charming Tina Omoro Obas as she clock plus one last week and when we sidon value dis Tina life we gbadu her style as she carry her most expensive cake and other gifts go give Orphanage Home children. Tina i throway my two seedy and my blukus for plate,also i wage d kola wit Ejaife Odebala and Roli Uduaghan as we hala HAPPY BIRTHDAY to you. TINA oya dance make i spray you wit cowries. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 29 Jul 2014 19:57:03 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015