~~~~~~~~ PSALM 23 ~~~~~~~~ 1. De LORD na him bi my care - TopicsExpress



          

~~~~~~~~ PSALM 23 ~~~~~~~~ 1. De LORD na him bi my care taker, I dey kamkpe. 2. He make me Sidon for where beta beta de flow, and come put me near RIVER, I no need Air Conditioner because my bodi dey Thermacool. 3. Him panel beat my soul, come spray am with white paint. Come de even lead me dey go through express road of Righteousness because of him name. O`lon, maka Chukwu. Walahi if l waka pass where ARMED ROBBERS dey, 419 ooo, JUJU PEOPLE boku, BOKO HARAM, self join, come even reach SAMBISA and pass near EBOLA RIVER, without SALT and HOT WATER, or even come follow bury PATRICK SAWYER, my bodi dey inside Him (De LORD) cloth. Him Rod and walking stick fah? na dem bi my power na. 5. Him don prepared correct beta chop for me, come go set am on top correct ogbonge table make l sidon wak like se l bi president. Na so all my Bad Belle people come dey look waa-waa-waa. He rub my head with beta Vaseline and correct cream. My Cup full dey trowey like River Niger. 6. True-true, na beta life and mercy go gum my back and dey follow me bomba to bomba like my shadow until I kpeme. And MAN PIKIN go tanda gidigba for God house lai lai to. lai lai. AMEN
Posted on: Tue, 12 Aug 2014 14:55:13 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015