SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 04/12/2014. LIFE NOR GET - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 04/12/2014. LIFE NOR GET FORMULA E get one thing wey dey confuse me for this life about pipo wey dey make am. When I check the background of many great and successful pipo for this life, I realise say this life nor be mathematics wey you go ever fit use calculator take solve get answers. Now, if na muslims dey serve God well or nai be the true way of God worship, nai be say, na muslim person for be the richest man for this world. And many muslim traders and workers and bisness pipo nai for get money and dey successful pass many other religion pipo. If na christians nai God like pass, nai be say, christians for dey enjoy Gods grace and mercy pass other religion pipo. And if na free thinkers or pagans God gbadu pass, at least, na dem for dey rule the world. My pipo, I don sidon reason this matter sotay my brain wan loose. Na when I dey tighten my brain nai I begin see light for wetin I dey reason. My pipo, God love everybody equally. Benin pipo wey we know say dem dey always get spiritual back up apart from God, dem dey last well well even pass Yoruba pipo wey carry Christianity for head and Hausa pipo wey carry islam for head. Nor be say God love or accept one religion more than the other. No. Befor you be king, you first be humanbeing. Befor you be boy or girl, you first be humanbeing. And befor you know how to serve God through the way you dey follow, you be humanbeing first too. The issue of say one religion better pass one or God like one set of pipo pass another na lie. No matter who you are, God loves you. Becos nai God create you. Stop the comparism. Stop the evaluating and the discrimination. For our politics today, some pipo say dem nor want a president wey be muslim and vice go be muslim. Say dem go turn our country to muslim country by force. So, religion go fit affect our political life and dream? Make we get sense o. The pipo wey dey fight war na me and you. Those wey dey carry guns during election na me and you. If only you fit see your neighbour as a brother from another mother, I bet you, you nor go get reason to hate, kill, assassinate, kdnap, discriminate and even rape. This na wetin all religion dey clamour for- Peace and Love. No person better pass the other as in creation becos God create us differently with different abilities. I don see blind man wey get sense pass who get okporlor eye. I don see cripple wey strong pass who get kobo leg. And I don see deaf wey love pass who dey hear well. Now, how we wan take calculate how to become successful when e nor get formula? Na to work hard? You never see truck pushers? Or na to read books or go school? You don hear Tuface matter? Na to serve God or go church? Which church dem late Sir Isaac Newton, Michael Faraday, Socrate, Leonardo da Vinci or even Bill Gate wey dey alive dey go? My pipo, boon matter. When dem create us, dem nor give us any formula to take solve the problem of breakthrough. Na key God put for our hands. Dat key dey with all of us. The key go only meet the lock at the right time. So everything boils down to time and chance. When your time reach, if na water you dey sell, you go use am build house. Imagine how musician go sing song wey nor pass 5 minutes if dem play am. Just one song go make company or record label pay am #5 million. Imagine am first. What about footballers? And even politicians mostly house of assembly members? The moment dem win election, their life don change. How many years Hon Igbuya take sell meat for Sapele? The years many pass the years wey e don spend for politics. But when e dey sell meat, e nor fit gather money take buy land. But today, time and chance make am millionaire. Na him serve God pass? Or na him God like pass? No. My pipo, when your time come, you go fine pass the most beautiful girl in the world. You go gap Usaine Bolt for field and track. And you go win President Obama for election. Just relax, na turn by turn. Nor look down on yourself say you dey serve God wrongly nai make things tight. No. Let your conscience be your judge. Anything your mind condemn, nor doam. Just focus on the true path of faithfulness, honesty, diligence, trust and love. Once you dey there, God dey dey with you. In all, as a Christian, muslim or pagan, never you look down on any person wey nor share the same faith with you. Mind your lane becos the God wey dey answer your prayer nai dey answer their own. If nor be the God sef, God Almighty nor give you right to judge anyone. Let God fight He fight. Make I drop my pen now cos my ink don dey finish. In summary, if you dey serve God without loving your neighbour as yourself, na you know sorkor. God love everyone nai make e dey allow Sun and rain dey meet us all. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 04 Dec 2014 14:19:29 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015