SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 09/12/2014. UPGRADE. When - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 09/12/2014. UPGRADE. When Aunty Eunice dey teach for Ethiope primary school, she dey among the best teachers wey get fine hand writing for black board. When she dey copy note, na so the chalk wey she dey take write for board dey shine like wetin dem use kernel pomade take rub. She cum marry. After about 9 months, just befor the third term exam over, she cum born boy pikin. As a governement worker, dem give her maternity leave for 6 months. My pipo, befor she resume, government cum select 5 primary schools make dem upgrade. Na so dem still train some teachers on how to follow up the new innovation. Now, when Aunty Eunice leave don over, she cum resume school make she continue her work as usual. When she enter the school, she just fall in love with the new face lift wey government give the once dilapidated school. After the students don finish assembly enter class make dem start lectures that morning, she surprise to see say dem change the chalk board to pvc marker board. That white board wey dem dey use marker dey write put. Different electronic slides for educational activities dey different corners for the class. Computer dey the class teacher desk. She just laff becos she nor know how to press computer. Na where she for dey turn round for the class room nai the headmaster send one primary 6 student to go call her cum. For headmaster office nai the headmaster for tell her say dem don write her name join teachers wey dey go for the next computer training. Say make she nor worry. Na that one nai bring her mind down. Say dem go train her for 2 weeks and she go fit use the computers wey dey the school now. My pipo, at a time, na chalk we dey use take write for slate when we start school. But today, na pencil and excercise books. I know say many primary one students dey use biro now. Dem go soon dey use laptop. Befor, na black and white television we dey watch. And the tv dey come in ekpeti form. But today, na flat screen LCD. Everything na button and digital. In those times, na letter we dey send, if we like babe. Today, na handset we dey use dey run package,via Email,Facebook,Wattsap and other social media. My pipo, everything na upgrading. And we must upgrade follow dem. So, make we continue to dey upgrade in our businesses, relationships and career. Na Holy Bible pastors dey use befor, but nowadays, na laptop dem dey press for altar. When you say make pipo raise their Bible up for church, na handset pipo dey lift. To upgrade mean say we nor wan comot from line. Na upgrade dey make our network service providers dey still remain for bisness. Today na free night call. Tomorrow na double recharge. In all, nor remain one place for a long time otherwise, pipo go waka pass you for life. When banks dey upgrade to computer level, all the banks nai upgrade becos dem know say things don change. My pipo, upgrade yourself to meet up with the change of things. If na to learn work, nor waste time. If na to go school, begin buy form. Na here I talk this one reach. In those days, na every now and then I dey see fowl dey purse eachother if dem wan straff. But now adays, dem go give eachother sign, then waka go one cool corner go commit. All na upgrade. Make unu help me solve this word problem. One goat plus 2 cow is equal to dash? God Bless Sapele. I LOVE SAPELE SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 09 Dec 2014 13:36:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015