SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 15/05/2014. Dem nor dey - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 15/05/2014. Dem nor dey sidon for inside River dey complain say pepper dey person eyes. I dey talk since but e be like say one Sapele Principal for one of the secondary Schools one dare the strenght of dis page. I dey use dis update dey remind everybody say,if other people for outside dey misbehave,nor be people from either dis forum or dis town most especially. I waka waka a very long journey before i fit buy phone wey i dey use take dey update,den later on person cum dash me Laptop only say she take am back. So for me to dey manage my life wit hardship to dey use Asha 200 dey type and post to make sure say Sapele and Delta State better,i nor see any reason wey one stupid Principal go come say na him wings nai long pass say make e oppress students for school wey i attend reach Class 4. I dey call on all old Boys of Okotie Eboh Grammar School and the State Government to call the current and incumbent Principal of Okotie Eboh Grammar School to order before i go issue am sack letter from here,and before i go do that i go make sure say i site pepper for e eyes and rub am powder of International disgrace. Report reach me yesterday say dis yeye Principal open e gutter dey tell students to buy and supply one School Bench each to the School and failure to do that dem nor go allow the students write exams. I just sidon dey laugh becos dis Principal nor know the value of students wey dat School don produce and na just a single phone call nai go unseat am from dat School and make am jobless if e nor take care. On what ground students go buy bench for School? We dey talk of lapses of Government to provide siren environment for students to read as LIBRARY after School and during Holidays dis kpafuka Principal dey here dey impose more stress for the students and parents to buy School bench. I pity for you well well and i dey call the authorities to go investigate dis intel very well and redirect the School Principal to reverse e statement now or expect the worst venom from this page. Nor be our era dem for dey oppress people dey go scot free again. I nor wan talk too much becos many of my fans dey complain say dem nor dey see my update finish,so make i end am here. To all Old Boys of Okotie Eboh unu go agree wit me say na Okotie Eboh gateman den nai dey use dis word UNU and na from dere nai we from borrow d word. So we nor go fit sidon make one Principal sidon dey afflict pains to our successors and we go quiet. Na Government responsibility to provide Chairs,Reading Materials and Shelter for the students to enjoy the free education wey dem dey profess. My people how unu want make we do dis Principal if the authorities dem dey slow becos if i talk wetin dey my mind na e family nai go use head carry am. I remain the Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes of Delta State. God Bless Sapele. Oya suggestions,abi wetin d Principal dey do now correct? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 15 May 2014 06:42:37 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015